who we be

in #naijapidgin6 years ago (edited)

DQmQ2FzwofMUx4b5SLxs6d55uQgurie5pT6BckkwmvPkFQL.jpg

My country people I trowey salute for unah o.
How unah dey?
How unah take the hold body for this we change?

Today nah another fine day wey we go like yarn unah another ogbonge tori but e be like say since we dey yarn unah tori for here we never tell unah who we be wella.

Nah we them the called naijapidgin and our work nah to the bring unah fine, fine tori wey dey happen for we country for we pidgin language,
If you like you fit talk say we too the do Amebo, but any how you see am this na the thing wey we go the do.

Nah @ogoowinner arrange this house wey we dey use yarn so, and nah because she don reason say e go better if we too go get where we go fit de use our own pidgin language dey follow reason with we people, no be say every time we go the yarn with oyinbo people dem language “this pidgin nah we own”

She want make we use this place “naijapidgin” take the help ourselves for this place wey we dey write to make money (steemit).

So nah just like we get @genesis-project naso we want take arrange this place so e better make you join the people wey start am.
So for all the people wey like pidgin language and sabi yarn wella for we pigin language so make we join body arrange this place.

I know say time go reach wey all of us go dey jollificate, so make we no tire kpatakpat, make we put head, hand and leg together make we make this place work.
Another thing be say make unah know say this naijapidgin nah for everybody, so anybody fit yarn em mind for here.
We get plenty ways wey you go fit yarn for our tori.
You go fit help us the comment for any tori wey we yarn about,
You go fit help us to the write or bring tori too so that we go the talk about,

So my country people if you get anything wey you feel say we fit to dey do or talk about wey go help us push this our community go the permanent site make you help us suggest am for the comment box.
Also you fit join us for telegram were all of us the robe mind every evening

Abeg remember to follow this account, upvotes and Resteem.

if you get anything to put for we community make put am sharp sharp for the comment box time no dey to check time.

10% of this post payout go go to the person wey him comment get enough people dey follow am argue inside and the one we get plenty upvote.

nah @oliverwilliams help us arrange this tori for @naijapidgin house

if you like join us for tellegram click here

nah @mittymartz help us arrange this beautiful avarta

DQmQkNYBpYh7mPEJV6KFqxCfneCsy8kYxgzH7Lg91z6zf7o.jpg

naijapidgin! we go d talk d talk

Sort:  

All of una weh dey behind as this naijapidgin mata take dey set, me dey roll 4 ground dey hail una o. As we don enta new month so, na mercies n favours Oluwa go use embarass una IJN....
Anyways sha, me no rili gt wetin to yan pass say, e good to join d communuty of beta pple cos beta people go generate better tns...
Carry go @naijapidgin

my brother you too much as you don take eye see wetin we dey do and you come like am better thing go dey follow you,
and as you don wish us happy new month so... make all the blessings of this month dey follow you too

na so o @naijapidgin, e no suppose pass like dat....

Though, me dey new to steemit sha, but wetin my steemit mentor tell me na say, to dey some kind communities na koko for person to make waves here...I go try join the naijapidgin community soonest....

Wetin ur mentor gist u no be lie cos na wen u present for all diz kind communities, na den u go fit dey get updates on the latest developments ontop dis steemit weh we dey so....we wan welcome u enter we naijapidgin community sharp sharp, mk am snappy o....

Abeg which community consists of fine fine girls pass?

As far as i know, naijapidgin get beta fine fine oshere dem o, if u neva join naijapidgin, broda na ontop long thing u sidon put o...

How i go fit join this your ogbonge community so?

We are from naija . One people great nation. Building a house here is all that matters truly.
Up we go @naijapidgin

One great nation one great house

Na correct one be this for the movement of we people.


Welcome to Steem @naijapidgin.

Do read A thumb rule for steemit minnows - 50:100:200:25 for starter tips.

Spend time reading Steem Blue Paper to know how Steem blockchian works and if you still have any queries ask them on our Ask me anything about Steemit post and we will try to answer that.

All the Best!!!

I greet you !!!! you dey make joy dey full my belle with all dis your post! you dey try gan ni, Great initiative... Carry go!

my paddi you know say naija no dey carry last, so this place weh we dey they must hear our mouth for here
so make we join hand leg and mouth move this community go the permanent site

my ogbonge @naijapidgin i twale for una ohhh una tooo nuch for this kind of platform way una create so we fit dey yarn for we languages well me way dey yarn so na confirm boy from the soil @jimmy9ja i hail ohhhh

this place nah we own so make we join hand make am better for all of us

true talk i full ground for this community

My country pipu
Naijapidgin Na place to be
I just wish say people go dey cooperate well.
most times we naija people dey so self-centered.we the think of only ourselves.
I happy for @ogoowinner.
she get better mind

Naija no get levels for steemit. Bad belle people too yapa for here.

Those wey don grow now no fit help the new ones. Check dem other countries tag na. U go see levels.

People wey get confam contents dey, wey dey rep NAIJA but na only @surpassinggoogle dey put our country name for here.

Abeg, make we dey help promote beta contents from our people too.

my brother you yarn wella, me i believe say steemit dey very big wey go fit collect all of us nah only if we go fit work together nah him we go fit move this thing go forward,
if all of us go fit the behave like @surpassinggoogle then this place go better for us,
so make we join hand make this place better for we naija people

me dey happy say I follow be member for this our ogbonge naijapidgin community. Make we join hand carry our obodo naija up ooo

The tin sef dey surprise me say, them come carry politic enter steemit.

Persin go publish post, na 0.020cent the post go generate for am. Abeg i no fit shout, seems naijapidgin don land for steemit, e for good make e elep us wen dey crwal for steemit dey upvote our post , even if na $1 upvote na something.

Na my mind nai mi talk o,anybodi wen no like watin i talk make e go hug transformer, i no fit shout.

Una doh oooooo

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.13
JST 0.030
BTC 65702.61
ETH 3485.24
USDT 1.00
SBD 2.51