You are viewing a single comment's thread from:

RE: who we be

in #naijapidgin6 years ago

All of una weh dey behind as this naijapidgin mata take dey set, me dey roll 4 ground dey hail una o. As we don enta new month so, na mercies n favours Oluwa go use embarass una IJN....
Anyways sha, me no rili gt wetin to yan pass say, e good to join d communuty of beta pple cos beta people go generate better tns...
Carry go @naijapidgin

Sort:  

my brother you too much as you don take eye see wetin we dey do and you come like am better thing go dey follow you,
and as you don wish us happy new month so... make all the blessings of this month dey follow you too

na so o @naijapidgin, e no suppose pass like dat....

Though, me dey new to steemit sha, but wetin my steemit mentor tell me na say, to dey some kind communities na koko for person to make waves here...I go try join the naijapidgin community soonest....

Wetin ur mentor gist u no be lie cos na wen u present for all diz kind communities, na den u go fit dey get updates on the latest developments ontop dis steemit weh we dey so....we wan welcome u enter we naijapidgin community sharp sharp, mk am snappy o....

Abeg which community consists of fine fine girls pass?

As far as i know, naijapidgin get beta fine fine oshere dem o, if u neva join naijapidgin, broda na ontop long thing u sidon put o...

How i go fit join this your ogbonge community so?

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.13
JST 0.027
BTC 57560.27
ETH 2570.10
USDT 1.00
SBD 2.48