HOW YOU GO TAKE ACTIVATE 9MOBILE DATA 1GB FOR 200 AND 5GB FOR 1000

in #naijapidgin6 years ago

image

Source

my country people, I don carry another ogbonge one come una domot. Una know say this we steemit work dey chop data wella and many of us dey complain say data we were load now now dey run like tap before you know everything done finish and where the money to dey buy buy data? Na im @naijapidgin come see this beta one say make e follow una share am.

Them dey call am "special data" and you go get 1GB for 200 naira and 5GB for 100 naira. The plan na for people wey like data but no get money to dey buy. For this post, we go yarn una how una go to activate this special awoof and how long e go last. The thing wey make sense die for this levels be say you fit do am for any phone weda na blackberry you dey use o or na Android or na symbian abi na Java abi modem abi which one you get. E no require VPN before e go work. Oya tuale for etisalat.

With just 200 pere you get 1GB data to browse, download and even watch all those videos we you dey like to watch online. But wetin you need to know be say na just 3 days e go work o. So if you do am today count 3days from today once e nak 12pm Dem go carry am go but na better package be this for all of us wey like to dey download wella and we belong to groups wey Dem dey post video upandan and for people wey their apps need upgrade but dey no get data to update am.

Oya make I show una how e dey work.

FOR 200 NAIRA TO GET 1GB

  • Buy 200 naira recharge card from anywhere you like o.
  • Dial 92910# on top your phone and then wait for the text message wey dey go sama you.

For 1000 naira to get 5GB, just do wetin you do ontop 5 times.

Okay my people, me @zizymena Neva try am o but I don see people wey do am talk say e dey work wella. Make una try am yarn us afterall who no go no go know.

Una good morning o. Na another Thursday morning be this. Everything wey you dey do, do am jeje. No drink dey drive, no find trouble, life no get duplicate.


Footnote

**If you would like to support us,

Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to *promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows*


Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

[Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Steemit Diary + Amebo with @rebeccafl [Fridays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapodgin Team:

The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...

@ogoowinner

@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg

Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

Hmm naijapidgin una don carry another ogbonge one come our dommot. This na confirm news, but zizy ah you fuck up oo why you no bring this news sooner na. And i just buy new Airtel sim well na to buy another one. Thank God say e cheap. Una dey do well

Una good morning @naijapidgin. This data tori wey u carri come make sense o. I Don tire for MTN and d way dem dey drink data sef.
I just hope sey 9mobile own go make sense...

I dey come, I wan go buy SIM

If you buy new etibaba sim, you load N500, dem go sama you 1.5g gor on week and another 1.5g for a month

Congratulations, your post had been chosen by curators of eSteem Encouragement program. Feel free to join and reach us via Discord channel if you have any questions or would like to contribute.


eSteem Line
Thank you for using eSteem

This plan dn dey pass one year na

This na better tori as you tok am... But if you check am well, person go still spend more in the long run. In 30days if person do am consistently, that is #2000(ALMOST 7SBD). Abeg how many person for here dey make that money for here with the current price of SBD.

I still prefer that AIRTEL overgara package. it lasts for 30days and you can use it when you want not because your validity period go soon finish.

Pls correct this
Them dey call am "special data" and you go get 1GB for 200 naira and 5GB for 100 naira.

How persin wan take get dat overgara package... Yan me the tori, I don tire for MTN.

Yan me about this overjara package now, to hustle in this life no be small thing o,to hammer sef? Uhm.

I don dey use the #200 for 1gig since last year and them dey nack me free 1gig when i recharge #1000 so i no dey leave the network o but how i go take do that 5gig for 1k?

Abeg yan me the tori wella. I wan switch. Mtn own don too much.

No be everybody got chop o, my padi try am but him no enter so make una try una luck sha

Guy, tell me more.

Na the yan be that o, he no pass92910# and jolly dey go

As I see dis tin ehn, rice wey wan turn jollof, e must enter pepper. Dem wan nack person 1GB for #200, only 3days. Hia! God dey.

Omo ehn, this data wey you bring go sweet o, i don dey hear am before but never try am, am you don talk am so, i go try am.
Thank you.
Chop kiss muan muan muan.

@naijapidgin, I dey hail o.
I dey feel you jare.
Carry go.

Omor see level o. Chaaiii and I don run go buy airtel sim yesterday. But no matter sha, make I rush go buy my etibaba simcard o. I can't fit shout again. Na this kind information wey @naijapidgin bring so Naim dey sweet belle well well o.

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 60004.45
ETH 2418.44
USDT 1.00
SBD 2.43