Our topic today na how una take see the plenty plenty killings wey dey happen for our country?

in #naija7 years ago (edited)


My naija people I hail o. 


Una don talk am na. Na wetin una choose we go discuss. 

Una say na the killing wey dey happen everywhere for we country be the next matter una want make we chuk mouth inside. 

Honestly that thing no funny again. The thing don dey pain me well well. People talk say na Fulani herdsmen dey kill people, but our government talk say na foreigners dem be. How una see the matter? 

Una think say ein get people wey dey sponsor them abi this foreigners just come from nowhere dey kill people anyhow ni? 

Make we chuk mouth discuss this tori as e take concern our country abeg. 

Make we also chuk mouth discuss as things take dey happen and the way forward. 

People wey win to collect 50% of our post payout for previous discussion na, @morenikej, @zizymena, @iamthegray, @peterakpan and @horlaide


Walahi, E no easy to pick this winners because everybody yan better for dat tori. We go dey use our telegram group (naijapidgin) to decide better. 

Person wey raise the motion make we discus this our today's topic na, @josediccus. Him go receive 5% of our liquid payouts for this post. Na him be the first person to drop the motion here.

Five people wey yarn correct things here go receive 50% percent of the sbd wey we go collect from this post.

No mind say ein small now, very soon e go big reach money wey our politicians dey share. Lol!  

Abeg remember to follow this account, upvotes and Resteem. 


Who fit make avatar for this account for us? Abeg show face. The other guy wey been say him fit do one for us, Abeg show face for telegram. 

Na for telegram we go dey choose our topics. First person to pick topic wey others agree with go get 5% of the liquid payout. 


Abeg all the naija pidgin lovers make do quick quick go join the telegram group for here.

Our Telegram: naijapidgin 


I hail of una o! 

Make una enjoy una weekend.

Sort:  

Tanku dis one no be based on the sbd now oo but if the sbd come thank God
The matter of killing for our country nija don tire everybody

People talk say na fulani but some add herdsmen abeg which one be herdsmen anyway me I belive say na Hausa people wae wan take over the country with their Muslim believe..... But at a time some Muslim go say dem no be Muslim... Because me I sure say them no be Christian and some say them b nijay but una know say our president sef na nijay and the guy no de do anything about the matter wae de ground

If na to share the country I no mind oo because me I no say once we do this Biafra tin the north go fall..... But most importantly how we de comot this our president wae de suffer people because he still open him gutter say make people no revenge the kill

This people wae de kill them no be foreigners oo them be nigga Muslims wae wan make nigeria Muslim country

Tanku

I nor think say na to break the country be the solution, we be one and we go make progress like that, wetin I think na say make government pass laws when go favor everybody.
Who dey train nama nama na him personal business, and mmake he go buy land use for the business.
If dem room about make them arrest them and seize the anamal. That one go be choopings for naija police i trust them, see them go seize nama them go take the job serious

Padi you know say during the time of Jonathan them get one mumu commitee wae de decide how this country de run

Na them de give Jonathan beer wae make am no think during him time now that set of people nai de decide watin go favour them and our figure head president just de travel up and down

and buhari wife de tell buhari but him ear Neva de work after all nigeria money wae them spend for the ear

Na true you talk bro, but wetin man go do na, this people nai dey rule the country, so na wetin favor dem them the tell presido to do

Abi na prayer we go pray
because this people get power pass presido self
na dem put am dere and since he wan come back for 2019
he gat loyal to all of them so things go pure for am
we dey they suffer the impact of all this their yeye wen them dey do
Na God go help us o

My sister called me early this morning from USA only to tell me say, make I no travel o because Fulani herdsmen they butcher people for road. Example was God is good motors, dem go shoot the tire so that when the motor stop dey will now massacre people. Seriously the govt really need to do something.
God help us.
Nice post

The government really need to do something o
but we get our role to play too
before we go wake up one day and naija don go

Abeg watin be our role

The government no care about the people he de interested in the 2019 election wae God go make am loose

Our role plenty o
We can raise a defense in our local places against these guys
Than to wait for government to do every thing for us

Them de fool wae de top seat no de do anything and vex de catch me

Bro if you fit travel comot this country enter road ooo
Because me now I de find money to enter Ukraine and I o de come back again

This tori wey we want discus na en be the current naija number enemy. God bless d person wey choose this topic for us.
I call this problem our number one enemy for the effect wey e go cause on the long run.
I no want go inside whether them be Nigerian or not,but to talk about the casala then they cause for us and our economy.
Whether them be Nigerian as paper go talk am today or foreigner wey the same paper go write tomorrow,the issue be sey we no want them for our country.
If you look am well,no be those people wey them dey kill go suffer the most,but us wey they living as well.
They don kill everybody wey still dey produce the little food wey we dey use to feed ourselves.
Remember,no one want to enter farm again,if you kill those people wey still they manage to feed us,sey you still believe sey na the dead go suffer am or the living?
Instead of our government to rise this need,them dey lie to us sey they no be naija people today,tomorrow they go tell us to leave as one country. With people wey no be part of us.
Hmmm,i pity naija.
Waitin i no go help us be say,we should handle the fulani headsmen as we take handle bokoharam. Whether them be nigerian or not,we should handle them like a terorist wey them be.
Instead of our government to dey use style dey support them,make we fight against them as one.
I dey believe in the in unity of naija,but our government should not separate us by prefering one tribe to another..
Na so i take see things ooo

My country people I trowey salute for unah o I say make unah dooh my name nah @oliverwilliams and I say make I chuk mouth for dis our torey wey we dey yarn today.
As I dey here d reason this my country matter so eeh…… e dey do me say make I cry, water don full for my eyes.
E dey very bad say this our country wey we bin the jolly before no be like that again, now person no fit to drink water drop cup person no fit to just waka commot anyhow because him dey fear make dem no kill am.
The real tory b say this killings wey d happen so eehh if e no affect us directly e go affect us indirectly.
This killings wey dey happen so ehh e don tey wey d tin don d happen o from that time wey goodluck bin the rule us for this our country nah him one group stand up start to the kill kill people just because dey bin want frustrate that man d time wey him been the rule this country ( some people say nah em political colleagues, some say nah em enemies, some say nah because him too corrupt so dem want make him commot because of that one dem com the kill people to much, I been witness Abuja own for nyanya ) nah this same man ( buhari ) wey dem the call baba nah him come outside say this killings go stop if we vote am e even pain me say him come outside come cry for tv.
now no be bokoharm matter wey dey face again now nah herdsmen. Nah dem no want allow people for we country rest again nah so so kill kill everywhere every day and our president sit down e no d talk any thing because nah dem e brothers.
D one wey pain me be say nah dss and igp wey come outside dey talk say na communal fight, for God sake hmmm
some even say this people wey dey do the killings no be from we country, my question b say how dem take enter we land abi our borders no d work again?
Me I smell say this thing wey d happen so ehh nah there plan and e no good
Make baba do something about am sharp sharp

my people @naijapidgin, e good as this better pikin @josediccus suggest the topic. Naija don tire me!!!... everything about Naija na so so tori e be.
To listen to them news no dey hungry me at all. people we sabi talk say " he goat head dey for him pocket" . Our oga wey dey top talk, say him dey fight nyama-yama wey dey we country no dey try weller. person life and animal life, which one better pass? as one ogbenge governor go visit victims wey this herdsmen/fulani people attacked and killed, na him our oga at the top go visit the attackers cos say 40 of them cow was killed. @naijapidgin, make una answer me, our lives and animal lives, which one better pass?....
them talk say na foreignerwey dey do am. e mean say our security dem no dey do their work abi our oga at the top don sack them finish?...
even if we say make we restructure naija, where you go start? To stop the so so killing, i dey suggest two things

  1. make them give each state the authority to control their state matter, matter like "security, economy etc.
  2. make every tribe for naija be as them be before oyibo them come. wetin i talk come from my heart, no be because of the reward !!! @simplicitytech

If you say make every state handele their matter that one dey
but the state nor go agree because them want oil money when federal gov go shared to reach them well.
na the problem be dat

No be small thing as I see my name say I win for the last episode o. Body sweet me no be small. this killing wey dey go on for we country I no understand. DSS talk say they be foreigners. Which kind yeye foreigners Dem be.okay if they be foreigners how dey take enta d country? Na now Dem know say na foreigners them be? Na now wey benue state house of assembly pass anti open grazing law for the state against miyetti Allah na im dey know say na make d killing dey happen but dat one na lie. Who be president for this miyetii Allah sef. Abeg make una shook mouth for this matter. No be nama we president dey rear before e become president? You go come talk say him na foreigners too? Okay make we agree say dey be foreigners abeg na for where you don see say foreigner dey get land for another man country weyy e go dey rear him nama. Ojoro full disclosure thing. Na our people for ugwu hausa na Dem dey do this thing. Na our fulani people dey kill people. This people dey look for how dey go take comot we wey no dey knack head for ground for this we country. Dem go because of nama dey kill human being.sebi sambisa forest dey. Why dey go there?

If I want rear pig now dey go give me land where I go do am? They just dey cause wahala bo be say Dem dey pay tax yet gomenti no go pass law wey go make d killing stop. You know say fulani na to dey conquer dey Sabi.

Wetin go good na make we gomenti no allow dis people use fear dey destroy people Dem dey call Dem common criminals. Na terrorist this people be. Wetin DSS and gomenti dey wait for.na until dey kill us finish for this we country? E be as d matta get o.

Na Dem Dem na Dem dey support Dem. @naijapidgin I tuale for you o

I love your point here, government gat do something before them kill every body finish
Them need pass good laws when go favor everybody
If you wan train animal go buy your own land and use
shikana
na my point be that o

I hail all of una o, my name na @Josediccus, as we be dey discuss this Tori, naija na we own, e go make sense if e good for our president to dey kpeff well well, benue na part of our naija, why our president never go there go helep the people wey be say their person don mud for the herdsmen hand?
As e dey go I see say na because all of them na hausa that is why our president never react he no wan punish them because e know say 2019 election they come.

However this one bad, ordinary say one woman husband mud for Edo because of police wahala, the governor Obaseki don visit them family even give them 10 million, why our president dey run from benue?

Na my yarn be this e be like say our president dey do wayo and for this 2019 no go work for an.
Na my yarn be this.

I still be una fine yellow boy @josediccus

You don talk your mind o
But this matther pass the one when president go go visit people, i think say the way forward na laws when go favour everybody and put this guys where them surpose dey

Our country people dis killing for our country no go help us for better nation building we need to be together to make our country better and for better thing to happen for our nation

you talk well my broda
na unity we need
if we fit come together naija go better
make we see how e dey go
i believe 0ne naija na the best thing when this country need now
na my own i talk so o

My country people. This matter wey we dey yarn get k-leg oo. Seh no be last year wey our government rush call IPOB terrorist group? And how many people dem even kill? But see this wahala na, our presido just no wan shake body. Nawa oo. No be say I dey support Biafra oo but this Fulani herdsman people just wan use style style destroy our country.
Abeg @josediccus you try jare for shining tourch ontop this matter.

lol
na style style militancy take start even boko haram
abeg make pyton dance for these guys make matter end once and for all

Halo ma country people
Herdsman don kill o, herdsman don kill ooo, falani don take control.
Before I chuk mouth for the matter wey dey ground, ma appreciation dey waka go @ogoowinner side for choosing me say I be one of the winner for the previous contest wey she do , I thank una we we .

I no know how I wan take yarn this matter wey they ground cos the matter self don cos argument self.
Ok o make I follow the back side yarn am.
One koko thing wey I know be say all tribes wey dey this country get the way dem dey do their stuff, Make I dey loyal to my conscience ,this fulani herdsman of a thing dey guilty for one side and non guilty on one shikini part.

Make I first yarn the guilty part
Na this one dey pain me pass, say make person dey punish or kill innocent souls, all this this wey una herdsman abi wetin una dey call them dey do neva reach the thing wey oerson they do wey be say dem go banish him. But the koko problem be say dem get upper hand because say BUHARI na from their side. Na Buhari dey provide dem d thing wey pass ammunition or sponsoring wey @ogoowinner don yarn before which is IMMUNITY . If immunity don stand gidigba all other thing go surely follow.State of emergency for there area wey be say our presy go cancel am because say the fulanis be im relative. And also he don do their negotiator with the federal government once..

Time no dey o make I kuku go the not guilty part.
*All the killing wey be say we dey shout up and down self no be the fulani dey do am but the problem be say 'once a culprit forever a culprit' .Because the one wey happen for ekiti state self, na yoruba people kill the Tiv people all in the name of una falani herdsman..
**make we dey sincere, if person wan dey block ur source of living wetin u go do_ kill him or wettin

To ma fellow steemians we fit raise a protest tagged END HERDSMAN
@horlaide cares

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.14
JST 0.028
BTC 58603.60
ETH 2628.30
USDT 1.00
SBD 2.45