Confused Love Matter 💏

in #fiction6 years ago (edited)
I greet una my country people... And I de welcome una to this Naijapidgin ogbonge blog
Abeg as e be now.... I need to know watin una go do if this matter meet you

heart-48522__480.png

image credit

I meet one bobo 7days ago and me and this guy don de chat de call since and I come say make I visit this Bobo on Saturday, we talk wella but the guy no "DO" me xha and when night don de come I tell the guy say I don de go house and the bobo start to de beg me say make I sleep for him house that night, na so him friend sef come de beg me too.... But my body no gree me stay.

IMG-20180403-WA0002.jpg

So easter monday yesterday me and this Bobo comot again and the Bobo still say make I follow am go house and I tell am another story why I no go follow am.... The Bobo call me come de Para say I de post am and him wan "DO". so the bobo come ask how much to take "DO" me and I like this bobo ooo and na everything wae babe de find for man the bobo get...
The question now na say How I go tell the bobo and him go understand say I no b Olosho.?

Na @mittymartz bring this matter come today

IMG_20180319_092844_398.jpg
Na @mittymartz design this avartar for our ogbonge community.

Sort:  

I like your tory but even if you like the guy e no mean say make you do...
And e don even ask you how much e go pay you, e mean say him see all girls as olosho...so no do

The bobo na ogbonge werey boi, he just wan chop you clean mouth, abeg no gree follow am

Omo, this matter no be here ooo, if na me be the girl, I go slap am ni, which kian Parol be that, why you go talk say you wan pay to fuck me, I resemble olosho for your eyes ni, the fact say I come greet you for house no mean say I be olosho na. Make hin go pay hin sister, l if na every girl you see for road you go tag olosho.
You fit Fuck am if you like am sha, but if na me ooo, I go make an understand say den no dey address anyhow lady like that and I will leave.

D bobo head dey touch i swear, wich kain yeye question be how much to take do,
d bobo no reach joor, forget am waka ur way, ordinary to dey totori babe head until she gree do willingly this bobo no sabi mtcheeeeww .
Shout am for hin ear ,see how person use style call you olosho u dey pity am to ansa am
U sef dey fall hand sometimes

D bobo head dey touch i swear, wich kain yeye question be how much to take do,
d bobo no reach joor, forget am waka ur way, ordinary to dey totori babe head until she gree do willingly this bobo no sabi mtcheeeeww .
Shout am for hin ear ,see how person use style call you olosho u dey pity am to ansa am
U sef dey fall hand sometimes

This matter na small matter na... E clear say wetin the boko want na wetin oyibo people dey call "one night stand" and e still clear say you no want that kind thing. So e dey very simple. Just tell am say you no be that kind person, notin hard for that one. Just tell am. But anoda thing, before the guy begin dey reason you as olosho, I believe say u self show the guy some signs like that maybe how u take dey dress, how u dey talk and other things. Make I drop matter for here for now. I leave matter for matthias

Omoh this matter dey taya me sef.sheybi gal no get choice again abi as person just dress finish follow u go house e coming mean say na invitation to come chop?

People who liked this post also liked:

Can Bad Memories Be Erased? by @emmaculate

MEET A WHALE WITH @JAMESMOVIC....episode 5 by @jamesmovic

Day 24 of the SSP: ARESEJABATA/PAP has its winners. by @funmiakinpelu

We are Discover Steem, if you like our work consider giving us an upvote. :) If you don't wish to receive recommendations under your posts, reply with STOP.

Coin Marketplace

STEEM 0.15
TRX 0.12
JST 0.027
BTC 55213.27
ETH 2919.78
USDT 1.00
SBD 1.95