Wetin i dey miss? 1Steem now na $3.24 and 1sbd na 13.48. This Holiday go sweet.

in #pidgin-english6 years ago (edited)

I greet all my people them, both People wey dey miss me, people wey no miss me and all the people wey i miss. Infact i go talk say i miss steemit and as i miss steemit i miss all of una be that.

E dey pain me for body well-well say i leave steemit for some time. Abeg make una no too blame me, na condiction dey push me around. And as a man wey i be i no suppose talk much untop my condiction matter. Because no condiction dey permarnent.
20964.jpg
I collect the picture from here: https://cliparts.zone/clipart/20964

Day before yesterday as work carry me come back to my place. I come say make i check wetin dey xup for steemit as e dne tey and i don dey miss all my people dem for there. Na him i begin notice say betta dey wella for steemit.

As I check my wallet today
i come see say my account vallue pass wetin i been dey see before na him i begin confuse come check steem price for coinmarketcap.com come see say 1 steem now na $3.20 almost 1,200 nigeria money, and sbd now na $13.48 wey be almost 5,000 nigeria money. Na him be say if my post get 1sbd i get 5000 naira be that, oboy!
PicsArt_12-19-01.17.05.jpg
na me screen screenshot am now

These one na progress ooo, steemit go soon turn to millionares club as i dey see am so. Thank God say i join steemit oo, all this my padi dem for my area here wey i dey try to bring come steemit but dem dey carry my moral down, i go begin do shakara for them very soon.
Them no go succeed again As them wan try bring me down from steemit, now na me go bring the up to steemit.😅😅

With steemit this holiday, chrismass and new year go better for my side.U5dtrbZ5D3F7HZTjUXfdWmYLh1kgmsb_1680x8400.png
I get this picture from @ogoowinner post from here

You fit support me with your Upvote and Resteem.

Comment make i reply you as we dey flow.

ionlyspeakpidgin dey Thank Una

IMG-20171021-WA0001.jpg

Sort:  

bros nothing spoil, enough time still dey to run things oo

No be lie. Steemit go pay my christmass gift. I trust am

I gbadun dis your style gan. Nothing spoil sha, no reason am, we go still flex the steemnaira well well. Me Don already miss this year Christmas sha. Na next year I go popori well well.

Upvoted. Resteemed. Followed

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 61451.22
ETH 2929.56
USDT 1.00
SBD 3.65