The Creed Of Life. Npc 3

in #npc6 years ago

My Country People, una weldone oo. How e dey be for una side? I no say una flex una Sunday well.. My side worry Shaa cos Nepa no gree give light since.

bgIGXbK.jpg
Image Source
Una don sabi as e dey be naa say anytime wey I dey raport for pidgin, Na im be say @ogoowinner dey gidigbam for my back so I want first comot cap give her. @Ogoowinner twale baba. You too much joor. After you na still you.

So today Wetin I get for una Na wetin oyibo dey call creed of life but I go do am for pidgin.

Me gan like this eeh, I believe say everybody get right make dem give them listening ear and see wetin dem dey do then come Love dem join.

I believe say everybody for this world dey the same level. Nobody better pass anybody here wey we dey so make we calm down no dey carry shoulder up.

I believe say this world wey we dey go enter everybody so make we no dey jealous ourselves. Shine your own make I shine my own.

I believe say everybody get Wetin im sabi do well. Something wey be say if him no sabi am, nobody else go sabi am.

For this world we dey outstanding. You no fit be like me and I no fit be like you so make we no try be like another person rather make we try be the best version of ourselves.
IMG_20170821_181645.jpg
No forget say race wey we come from and religion wey we dey practice Na wetin people create to use dey control us so make we try get human mind first anytime we dey relate with person.

For this life, I go dey treat everybody the way wey I want make dem treat me. I go dey relate with people fairly.

I no go dey do selfish business wey go profit me alone then my person wey I do business with go come lose. Mbanu

I no go dey judge person on first sight. I go try know wetin make the person do wetin him dey do.

I no go dey jealous my neighbor for him business and before I comot this world, I go do something for mankind. Something wey go help make people life better.

For this world, I go remain original. I no go do something because say person do or say I wan be like the person. I go do am because e good.

I believe say I fit change and improve the world make am better place with my creativity and I no go allow make negative thoughts discourage me.

Finally this life no be competion so make we take life jejely because everybody must achieve something.

I believe for Peace
I believe for Love. Love is the greatest.
I believe for Charity
I believe for Justice
I go begin live dey impact lives no be to just exist.
received_1562469580476052.jpeg

I @udembahenry go dey abide by this creed all my life.

Sort:  

nigeria represent

Good initiative, never underestimate Metcalfe's law. The more infrastructure around steem, the more valuable the platform.

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.12
JST 0.027
BTC 65216.94
ETH 3531.61
USDT 1.00
SBD 2.44