Pidgin Contest: The creed of life (@ogoowinner)

in #npc7 years ago

This na my correct entry for @ogoowinner pidgin english contest for the creed of life NPC episode 3 wey she nack for her blog

https://busy.org/life/@ogoowinner/the-creed-of-life-npc-episode-3

  • Me gree say na every pesin get full right to make people love, see am and hear am
  • Me gree say all of of us in the world we be equal na Baba God create all of us
  • Me gree say this world big well well for for us to live life jeje
  • Me gree say no mata how he be every pesin na original for something
  • Me gree say every person in this world dey special and unique
  • Me gree say every pesin get esu inside and also get angel inside am, but for me oh I go try well well to package the esu for tight corner, so that na only the angel go get beta chance to show himself
  • Me gree say our tribe, religion and position for life na notin but na stingy wicked people naim carry am for head,sothat control go dey dere hand, cause gbege and put am for people mind say na them be all in all but me chose to be “correct pesin wey get sense” before tribe , religion and position for life.
  • Me na wetin I like people to do to me naim I go do to dem also
  • Me no go just dey behave to people anyhow becos of who dem be but becos of who I go like dem to be
  • For me any mata or business wey go cause gbeke, kasala,my hand no dey inside a gain
  • Me I go try to dey understand people inside of make I dey judge them about
  • Me no go allow carry body, tight hand, jealousy to control anything I won do for this life
  • Me, before I go kpai comot for the earth I go do big thing wey people not to forget me like dat
  • Me go try to dey agile, strong and kampe when alarm don blow, kasala do shele, gbege do burst
  • Me no go gree for fear to package my life for one corner
  • Me no go gree for anyhow bad thinking to come full my mind but as the bad thinking they come I dey resist am sharply and dey replace with coreect and beta thinking, becos thinking get power 2much, if I thinking anyhow my life go become anyhow but if I think well my life go go well
  • Me, na original I go always be, I no go be copy copy of another pesin , come dey lie anoda pesin life tufiakwa!
    *Me, go make beta difference f I put only my best for anything I dey do
  • My life na one big journey for me no be race at all ,me no go dey competition with any pesin. Every pesin get him life to live.
  • Na peace naim I get hand put
  • Na charity naim I get hand put
  • Na forgiveness naim I get hand put
  • Na love naim I get hand put
  • Na mercy naim I get hand put
  • Na justice for every pesin naim I get hand put
  • Me, don decide say I won “live” life, I no just come exist for life to be like musin musin for this earth
  • Me , myself and I Efe Eric don declared say this naim my creed everyday for my life

imageSource

Before I end am abeg @ogoowinner see my NPC episode 2. Wetin my friendly enemy don do me for this life.(he disfigured my face)

https://steemit.com/npc/@eprolific/my-npc-entry-wetin-friendly-enemy-don-do-me-for-this-lifr-f87a747f6b9db

My pipu wey go read, upvote even resteem am una dooh

Sort:  

no b lie Oga. where de ppl wey won do the contest na?

You be correct warri guy @ eprofilic. Abi no be so?

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 59035.93
ETH 2519.79
USDT 1.00
SBD 2.47