My NPC entry: Wetin Friendly enemy Don do me for this life

in #npc7 years ago (edited)

This na true life matta oh. When I dey around 17 yrs

My pipu, did matta happen when my family relocate from Lagos to my village wey dey Effurun Delta state. Na alarm wet won kpai my family for Lagos naim make we relocate oh in 1996. Na pipu say if you dey Rome behave like roman, we don find ourselves for village we must behave like villages.
Na farming tinz naim come be the main hustle we come take dey survive. I come get village padi's(na some of them teach me to masturbate read this tori for here I explain everything dere) one name na Terry but we dey call Boyboy.
One day Boyboy say make we go catch fish for river, naim be my first time to go catch fish, no be small happiness full my belle, him get me hooks, we go dig earthworm ready to go catch fish. As we, dey go to the river Boboy come stand by the corner of road of the bush path to the river, he say make I come, as i come, he come tell to cut one small trees, me wey be first class mugu no know say wasps(my language na akpabrisa naim we dey call am) dey the small tree as I cut am, one of the wasps first cite me for corner of my hear, me wey no wasp shout “ chai which kain big mosquito be this wey cite me, I kill am, still one cut the tree before I look am dem don gather me they cite me anyhow, naim I troway hooks, cutlass and my cup of earthworm, my pipu see me for race,
imagesource
whereas Boyboy hide for corner dey laugh me seriously. I come dey cry almost one fight Boyboy. Shey una see wetin this friendly enemy do me. My ear and corner of my eyes and my lip come add better weight I mean my face swell up well well. If you see my face you go know those wasps dem be correct makeup artists

@ogoowinner you too much for this contest whey you burst out sha, I carry hand for you

Sort:  

correct story as a wafi boy i know the feeling.

Bro no be small thing

This preaches a lot of lesson.
Thanks so much

Thanks for visiting my blog

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 62221.65
ETH 2424.80
USDT 1.00
SBD 2.55