Pidgin Post - Wetin Steemit don Do for my Side

in #npc โ€ข 6 years ago (edited)

With largely insincere apologies to the non-Nigerians reading this ๐Ÿ˜ ...

Nna eh, wetin Steemit never do for my side? Chai! Steemit na baba! E don give me money, e don make me to dey write steady, dey open my eye well-well make I dey see wetin dey happen for world, dey happen for my side, dey happen for internet. I don carry Steemit dey fit helep my people now and then for dis our Naija wey no easy. Steemit na teacher and preacher, come be berekete employer put on top.

NOPICTURES

abeg, wetin una dey carry picture do sef? who picture epp jarre?

Why I come dey write pidjin for here? Na because say @ogoowinner wey be one heavy boss lady nwanyi oma for Steemit, she come carry another hot one enter 18-yard box ohhh; she no dey play for dis Steemit of a tin. Na so I come begin dey see as people dey type for pidgin left and right for dis our Steemit. Na im me sef come say "Ah, so because say I dey talk big grammar upandan for dis Steemit, na im e come be say una tink say I no dey local? Oya, I go show una!"

Na im I come siddon begin dey type this tin oooo; I come see say Naija true-true full Steemit. Everybody wey I sabi come dey do am, whether na my colleagues for @africaunchained, whether na Blockchain Bloggers, whether na @genesisproject (abi na @genesis-project), all join. As for those wey never dey do am (like @misterakpan, @gbenga, @ehiboss, @dante31, @thatdamiguy, @fisteganos and the rest of our Discord [and former Sankofa] crew; wetin hol una? )

Di tin make sense ooo, see as my hand wey don dry for one week for Steemit just dey flow like milk and honey as per say na dis ogbonge pidjin wey I come dey type.

Na wa oooo, my heart don bellefull with happiness say Naija dey grow wella for dis Steemit of a tin. Una well don ooooo!

๐Ÿ‡ณ๐Ÿ‡ฌ๐Ÿ‡ณ๐Ÿ‡ฌ๐Ÿ‡ณ๐Ÿ‡ฌ๐Ÿ‡ณ๐Ÿ‡ฌ๐Ÿ‡ณ๐Ÿ‡ฌ๐Ÿ‡ณ๐Ÿ‡ฌ

Steemit Animated Stolen From ememovic - DQmWHUZjHQFFJKUioxVAkfyHpKP4QYTyM2R5bqjQfHvsbUH.gif

@edumurphy

Sort: ย 

Steemit Don do plenty for all of us. My own testimony fit make two posts. As for @ogoowinner tell her say I dey come with my own package

Asin ehn, d tin come make sense yanfu yanfu

Eh-heh na , no be wetin we come find for here? ๐Ÿ˜๐Ÿ˜Ž

My guy!! I swear your flows sweet, no be say them say. U na boss. Abeg make peace find u jare

My guy, na so I see am oooo ๐Ÿ‘๐Ÿ˜

ย 6 years agoย (edited)

Hahahaha...
I de feel ur flows. If them no grab, we go teach them, I go try post for pidgin sef.

You don try am, make I come see ya own ๐Ÿ‘๐Ÿ˜ƒ

E make sense as you yarn am. Kari go :)

You sef, carry come, no be only me go dey carry go ๐Ÿ˜

Hun hun my bros your pidgin na high grade. I dey feel you for here oh. Make u na dey steem dey go.

I dey your back bumper-to-bumper, boss ๐Ÿ™Œ

so boss good for pidgin like this

I dey kamkpe. Oyibo big grammar na my first love and e sweet well-well but pidjin get as e dey sweet, meeehn ๐Ÿ‘

pidgin add flavor

I have to confess, I couldn't understand you fully! Need to brush up on my pidgin o ๐Ÿ˜ง

Brush up oooo; pidjin dey very necessary for Naija, make you dey fit blend wella anywhere wey you enter.

ย 6 years agoย (edited)

@edumurphy you try sha. ๐Ÿ˜‚

But if you go gree, I wan challenge you for pidgin contest, you go see say I go beat you like small pikin for the show.

Iyaaaaaaa. If we do am, you no go even sabi when e go begin dey sweet you yori-yori for belle; na so you go come forget say na contest sef ๐Ÿ˜Ž

Hahahahah. @edumurphy, I gbadu your parole, show dem sey you dey versatile, you dey versed for correct English and English way no correct. Lol ๐Ÿ˜‚

Hahahahaha, all join, my broda.

Coin Marketplace

STEEM 0.26
TRX 0.11
JST 0.032
BTC 63585.64
ETH 3035.86
USDT 1.00
SBD 3.84