You are viewing a single comment's thread from:

RE: SUNDAY MATTAZ

in #naijapidgin6 years ago (edited)

IMG-20180304-WA0006.jpg
My people,how una dey oooo,i greet una well well ooo,i hope say una go church,this na my entry today oo,my people.

Wetin i learn today for church be say for everything wey we won do for life,weather we won open business o,weather na school we dey go oo,weather we won move our family from one place to another,make we seek God intervention first,make we no jump before God,make we ask God say baba God oo,wetim we won do,you put hand for am,because if God no lead us,we no go last for whatever we dey do, and again God get solution to everything wey dey happen to us,so if we face any problem,make me siddon or kneel down pray for God,God go answer us but before God answer us,me must to be born again ooo,if not God no dey our matter o

Sort:  

you look good oo biko. It be like say you dey choir for your church

Yee... My sister fyn small small... U too correct. Na dis 1 wey yoruba ppl de say oti correct. I troway salute for jare correct person

u talk am well ma sister; b.lik u go church tru tru

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.17
JST 0.033
BTC 63915.30
ETH 2740.13
USDT 1.00
SBD 2.59