SUNDAY MATTAZ

in #naijapidgin6 years ago

My country people I hail una o. Today na Sunday so make I first salute una happy Sunday. We don come again but today na play we want play.

E dey simple and we go like am well well.

image picture na from my phone

Wetin we go do today?

Snap wetin you wear dey go church today or you were go church. Drop am for the comment section and write wetin you learn from wetin dey teach for church today. If you no go church, I no know as you want do am but e better make you go church you hear?

After we go go telegram page then we people go choose the best five Sunday wear. Na Dem go win our gift for today.

Wetin you dey wait for? Oya alenle.

na @zizymena na im bring this one come nak una today o.

if you go link join us for telegram make you for dey win plenty gift oya touch here

image

@mittymartz na im design our avatar

Sort:  

My pipu una happy sunday o...today na first sunday of the month of march, so i no see reason why i no go go church.
BeautyPlus_20180304135934_save.jpg

But the tin way pain me pass be say i don reach house be4 i see dis post.so i cucumer just snap d pichure for my counpound.
BeautyPlus_20180304140243_save.jpg

Okay make i tell una watin my pastor preach today.firstly d name of my church na LFC(living faith church aka winners chapel.the topic way pastor preach about na #thanksgiving..he con tell us say make we dey give tanks to God at all cost no matter wtin d wahla be.
BeautyPlus_20180304135302_save.jpg
My pipu una doh o!

correct! dis ur gown too resemble the one weh e self wear go church today buh i don olrdy off am b4 i jam dis post.

Thanku...lol

E pain me say I miss this but no whatsapp, next Sunday I go ready well well

IMG_20180304_112945_053.jpg

My people for obodo Naija Pidgin i troway salute for una o... Today for church been be thanksgiving service and our pastor take time yan us about the many many blessing wey de inside if you thank baba God. Him talk say pikin wey de tell him papa thank you wen de papa do something for am, e go make de papa wan do more. Na de same tin wey de with God be dat. Today i nak that traditional wey somebody wey special to my heart been give me, and i nak am with gray trouser and brown shoe.
Na your boy @princeene001 #signingout

IMG_20180304_125854.jpg
IMG_20180304_083704.jpg
Check me out, I had it simple today, but I still enjoy God in the simplicity of my heart and look.
I fellowship at winners Chapel, oyo
Today's topic is "accessing God's plan for your life from his book.
Text: Jeremiah 29:11

IMG-20180304-WA0006.jpg
My people,how una dey oooo,i greet una well well ooo,i hope say una go church,this na my entry today oo,my people.

Wetin i learn today for church be say for everything wey we won do for life,weather we won open business o,weather na school we dey go oo,weather we won move our family from one place to another,make we seek God intervention first,make we no jump before God,make we ask God say baba God oo,wetim we won do,you put hand for am,because if God no lead us,we no go last for whatever we dey do, and again God get solution to everything wey dey happen to us,so if we face any problem,make me siddon or kneel down pray for God,God go answer us but before God answer us,me must to be born again ooo,if not God no dey our matter o

you look good oo biko. It be like say you dey choir for your church

Yee... My sister fyn small small... U too correct. Na dis 1 wey yoruba ppl de say oti correct. I troway salute for jare correct person

u talk am well ma sister; b.lik u go church tru tru

I don show.
I just upvote before run comot to go prepare for church.
The thing wey I dey do for God well well Na to sing and play for God house.
IMG_20180304_090924.jpg

That Na me in band stand.
And God light shine on me.
IMG_20180304_090829.jpg
today to na promise of the father.
the topic Na about the Holy Spirit. I learn say as believers we need the Holy Spirit so dat we go fit pray well well, make we no tire. I also learn say Holy Spirit Na person no be thing
happy Sunday my pipu

IMG_20180304_105524.jpg

me learn say God want the beta things for his children. Say this world know fit give us the best things but pipu wey trust their God, wey be God own know go lack better things because my baba God know wetin he go do. (John 6:6)

me i know too photo freak, so I know go lie, I know snap myself as i they go church but me present dis my Corp member picture wey she beg me make i snap am after she come from church. From next week, i go dey snap too every sunday

Lovely....with wetin my sister wear, I fit tell the church you attend.

my country piple, una good evening o, me I don show o, na your brother @mike4christ
IMG_20180218_173619.jpg

Biko wetin people wey no dey go church or mosque do....make dem post their house cloth selfie?

Zizy you make sense jare! I no quick see this post, I don pull my Sunday cloth before I see am. Next time I go participate. Happy Sunday.

Okay. Next Sunday just snap before you pull am😁

Happy sunday o my pipo...
So we weh no go church na, or we weh b muslims, una don disqualify us from today pakage?no b so e supppse b sha....
E no plum like dat o cos una no run dis kind pakage 4 we muslims on friday....
Una suppose sabi say na different pipo from different places and different religion gather dey here o.....
So @naijapidgin, mk una mk amends o....
i don yan finish my pipo....

No vex. You fit snap your own on Friday next week keep am till Sunday. No vex for us abeg.

True talk o. Abeg admin look into the matter.

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.13
JST 0.029
BTC 66494.63
ETH 3508.10
USDT 1.00
SBD 2.66