We don enter Second half!

in #naijapidgin6 years ago

image
source[renew]

My pipo una good morning, na rain today take start and i hope say e reach your aide as e be say e make everywhere coole.

The things wey don dey happen for we countri no be small tin and no be sometin wey dey totori person belle, na super eagles first start as dem jaa from world cup before we come here say dem dey kill pipo for both plateau and for ibadan, as we dey say make we dey recover from that one na im dis ogbonge one wey happen for where i dey pass sometimes for berger side just land again and we sabi say elections dey come and people get tori say all these things na becos of this elections wey dey come, i sabi say thins like this dey happen before but na to just dey pray to baba God make Him keep us o.

Na the matter wey ground be dat but i wan make we no forget say if you dey read this tori, e mean say you don reach the firat half of this ogbonge 2018, i still remember wen we dey jolly dey do countdown entrr this new year and be for we say Jack robinson...we don enter half time. Make we first thank Baba God say Him keep us reach this time, whether money come go, na life still be the most impotant thing.

My pipo i come want make una look as the thing dey go whether all the thing wey you plan don dey enter abi you go need to rearrange your plans, e fit be say na small break or vacation you go need make you take refresh and refire make your head coole again, but anyway na way so make una look am again, na another opportunity to make correct changes.
You fit even sama us with some kind tins wey you like do for this half time to see say this year go be correct one!

Na we be Naija
Na we be Naija pidgin

Footnote

If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows


Join our discord server for fun, interactions and voice shows here

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

  • Real-Life Talk with @preciousimo
    [Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapidgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain:
@ogoowinner
@zizymena
@oliverwilliams
@horlaide
@mittymartz
@nmalove
@preciousimo
@rosyblessing


Na @mittymartz design this avatar

Na your boy @preciousimo bring this one today oo.

Sort:  

@naijapidgin
I think say u pipu talk am for march say we go do one resolution something
Maybe na second half resolution
Well, all d best......

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 71181.66
ETH 3647.17
USDT 1.00
SBD 3.75