TAKE THAT NEXT OPPORTUNITY WEY THE COME..

in #naijapidgin6 years ago

accomplish-1136863__480.jpg
Source

My country people I trowey ogbonge salute for unah o!!!
How unah take they hold body for this our change?
I hope say everywhere good sha?

Today we don carry another gist come unah domot and for the gist wey we get we want talk about opportunity………….

they say to succeed for this life you need hard work but I say to succeed for this life you need hard work and opportunity.

As English dictionary take define opportunity………………. Dem talk say nah chance for you make you fit advance, grow, progress, or even make plenty profit.
But for we own ogbongo pidgin language we go fit define opportunity as say if you see any small chance to sama yourself growth you go take am sharp sharp.

Opportunity nah one of the ingredient for person to succeed for this life because anyhow you work reach if opportunity no come your way you fit dey there old

Okay make we check this example imagine people wey buy bitcoin when bitcoin still the small pass dollar sha nah millionaire or billionaire dem be now.

Every day wey day break nah em new opportunity dey come our way and nah different different ways nah em the opportunity fit show himself,
E fit come either through our friends, family members, our community, or even for our work place but even when the opportunity come our ability to grab the chance when e show nah him go make us different from other people

For example
When steemit first start nah so one of my good friend introduce the thing to me but base on say me I don suffer for Ponzi scheme hand before nah so I no come take the thing serious until after I see say him come collect big money go buy laptop nah then my eye come open but by then e don dey already late for me to catch am because him don go far.
Nah so everyday wey I remember the matta nah so so vex I go the vex with myself because now nah struggle I dey struggle for steemit.
That nah one of the plenty stories wey I get and I sure say you get the same tori too

no wonder them say opportunity come but once.

And one bad thing about missing opportunity be say nah so so regret and vex you go dey vex for yourself.

So no just sit down there the watch as opportunity they waka pass you, why you no go go grab am make you make yourself blow.

dangote, bill gate, mark no become successful because them dey fear to grab there opportunity wey show when e show.

So today make I take small time yarn unah about APPICS

Appics nah social media app way the hosted on steem block chain e go the work exactly like steemit but this time nah him go serve as alternative to instagram.
For appics you go fit the post pictures and short videos and when people like am you go fit the make money but sha for appics their own nah smart media token (SMT).
So right now them they make noise well well for anybody wey go fit use this opportunity invests in am.
Dem still dey do ico so if you get money you fit invest, and if you no get money to invest when the thing lunch for commercial use, make you make sure say you no dull at all.

So my country people me I don talk my own

E get any opportunity wey you don miss?
Or e get any opportunity wey dey wey you want make your naijapidgin people enjoy am too?
Or you get any matta to chook put for this tori
Make you run sama your own for the comment section

And if you want join our what'sapp group where dey thing the sup make you click here

nah @oliverwilliams and @naijapidgin bring this one come our domot.

no forget to follow our blog @naijapidgin, upvote , resteem and comment.

nah @marttymartz give us this fine avarta.

IMG_20180215_155325_695.jpg

Sort:  

Attention!! not on the link of
@sokolova click is a phishing site

I Don miss opportunity plenty for this life.
I no fit count, but as miss plenty opportunity Na so I learn plenty lesson too.
My guy dey do e masters degree for Harvard today, I suppose dey dere because I b get the scholarship too but one tin come delay me. I nearly run mental that time.
Others missed opportunities dey wey I no fit share.
But I lesson plenty lessons from them sha

Hmmnn.. Sorry oo.
Them say na only once opportunity dey come, but i believe say you fit see am again.

Me I no too serious when i dey school, when others dey learn professional courses take back up their degree, me dey form vandam, I believe say I no go need am, my certificate don do.

Now, I still dey hustle to get one. I don need am die.

And na free I for do am then o.😭😭

Na so o.
for school things Na either free or with small money. That kind opportunities go come again?
Na only when u go back to school if you want to run another undergraduate degree program.

Correction : For appics you go fit dey post pictures and ........

Check am well.

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

@naijapidgin, i dey gbadun una story joor.... Onelove

Opportunity dey say, comes but once, boh me no too belive sha, cos i know say e must always come again with faith

Try Our Service Before Buy🎁

  • Exclusive 30 days free upvotes to your every new post.
  • Limited Time Offer
  • No need to send any kinds of steem or sbd its full free service.
    we have paid service too so please check them too. Active the free upvote service and learn more about it here : JOIN NOW CLICK HERE

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.12
JST 0.031
BTC 61785.67
ETH 2891.86
USDT 1.00
SBD 3.54