SECOND CHANCE

in #naijapidgin6 years ago (edited)

IMG_20180215_155325_695.jpg

My country people I greet all of una o, how unah dey.
I welcome unah today again to this our ogbonge naijapidgin blog....

Our torey today go carry another different swag and I want make everybody for shook mouth put because nah wetin concern all of us.......

Today make we yarn about second chance, how we take understand am, and wetin second chance go do for us?

As I dey eh, I believe say everybody wey dey dis world deserves a second chance.
E fit be love or broken relationship, elected post, deadly mistake, or judgement day self.

I know say all of us wey dey here don reach different different places for this life and also don do plenty mistake wey we go d wish say, if to say Dem go fit give us second chance.

My own torey/experience wey I been wish say dem for give me second chance be say.
wen I just land for this steemit platform, as blogger and person wey like contest. Na im I just enter one contest like that all for say make dem upvote me. Everything sha dey funny dat day as d organiser just flagged the post come replied me say my entry no correct, cold catch me dat day, na so my spirit live my body.

All I come d think be say make dem just give me second chance may be I fit do something wey dey interesting ,right and good.

So, my country people how your story be? Were u don fuck up or Weting b that thing wey u go wish say Dem for fit give you second chance.
Abeg make we chook mouth put for this matta yarn well.
Maybe your torey fit help another person
And make we no forget to make am brief too sha.

10% of this post payout go go to the person wey him comment get enough people dey follow am argue inside and the one we get plenty upvote.

nah @horlaide bring this post before @oliverwilliams help us arrange am for we naijapidgin.

if you like join us for tellegram click here

nah @mittymartz help us arrange this beautiful avarta

Sort:  

I no too dey conversant with the pipo weh dey run dis naijapidgin community o, but e go be beta fuck up if i no hail una wella, so all of una weh join hand dey propel dis naijapidgin community, i dey hail una o. I dey hail 4 mandarin, cantonese and portugese langua o. As una dey use style add value to pipo lives,God go just dey add value to una own lives too o.

My torey tuff small o. On december 13, 2016, my padi 4 Abuja word me unto 1 ponzi scheme like dat weh some set of guys arrange, but na bitcoin dem use arrange d scheme. Dat year, i buy bitcoin worth $7.99, but as me no too sabi the bitcoin mata, i just send d bitcoin i buy to peson n stop to follow d scheme up. 1 year don pass b4 anoda 1 of my padi com gist me unto bitcoin mata o. Me come discover say d bitcoin weh i buy 1 year b4, weh worth $7.99 don gt value of $172.66. D tn come pain me well well. Now i just dey wish say mk i get second chance, take bak d hands of time come do dat business again,mk i buy bitcoin weh worth like $200, mk i see how much d thing go worth afta d same 1 year. @naijapidgin, una well done o

My brother thank you say u chok mouth for this our mata o.
No be small thing Ponzi scheme take our eye see I sure say almost everybody for naija nah him the thing show sege but thank God now say all men eye don open
Now nah to focus on steemit wey sure for us.

Me no even involve for MMM mata that year but na based on say d money weh dis 1 i do involve no much n i get enough, na y i enta...N no be say na sure loss, but na cos i dey ignorant unto bitcoin mata then, na y i just lose that kind opportunity and money...@naijapidgin, ignorance no b beta tn abeg.....

Hahahaha, my man, this ur tori carry weight oh, nd as the Mata take happen dy pain wella. But how cm u no carry police go arrest that your guy,? because this one nah better criminal case oh!

I just wan laff die o...
E sha no force me buy the bitcoin...

Second chance most times no dey come easy o... Na d price for ignorance be dat Sha... But Wen person come get d opportunity d 2nd time, na to mk awesome use of am....

My simple meaning of a second chance na pardon for being ignorant a first time...some foolish set of people go still misuse d second chance sef....

Na true u talk sha, some people no dey ever learn from their mistakes....result of that na say dem go dey foolish till thy kingdom come...

Ponzi scheme na d baddest tn weh happen to 9ja last year....second chance good 4 pple weh sabi d worth...

Thank God me no fall enta MMM trap then....
Dis ur short yan unto second chance so, e carry beta weight...
Oyinbo pple go say u dey short and precise...

As e be me for bodi now, i need this second chance badly...my tory be say e get one coin like dat wey dem call Dashcoin. Last year ma padi come tell me say make i buy am..i just dey with 40,000 naira wey i no won touch. I come say make i leave coin go use am do ponzi wey go give me sharp money.

Na em i carry the money go do ponzi, the site vamos,and i come loose ma money, had it been i use am buy Dashcoin, by now that 40k for be 17million now... i need this second chance abegii*...una weldone oo

No b small thing o, nah so d ponzi scheme river carry all of us that year.
E go better as e never late because I know say other coin too dey come wey you go fit invest

Na so o...na em be the matter wey i dey reason since. I go invest on steem with other coin wey brekete but with wisdom oo...i don tire for poverty sef, i no know if e dey be una like that

Cheii... Your own come good sef, if u see wetin dis yeye ponzi do me eehh, infact i need third chance sef.. I dey come with ma tory oo
Weldone @naijapidgin

Abeg, wetin be second chance?

Second chance na when you don mess up and person look am say you fit rearrange yourself, do the thing as you suppose do.

If you look that my definition well, you go see say no the person way receive the mess up for give you second chance and no be you way mess up.

Unto that level, people get different mind. Wetin I fit let you collect second chance fit be something way another man go talk say even him mama no fit beg am on top.

As this matter be, you no fit talk say make person give second chance or make he no give.

Na to day make sure say we day put our best for anything way we do. That way, when we don mess up, e day easy for people to reconsider our matter.

And for people way day receive other people mess up, well, make they remember say no body perfect. Na me today, e fit be you tomorrow. Make all of us, as e day our power, try to day help each other.

.................

For me, I want second chance for steemit. I hear about am when e first start but I no take an serious. If I fit go back to that time, omo, man go happy oii

I don yarn finish

My person thank you say you put mouth for this our mata.
U know say e never late for you to make am for steemit nah just to d work hard and to dey consistent

Amen o

Na wetin day give me hope be that

Tori aside , i feel say some people need second chance at life. The way dem take leave us ....

I go like talk my own for dis mata

We dey wait to hear your Torrey

Hw far all ma ppl for @naijapidgin I no go lie ooo but me no too believe in second chance bcos I believe sey everything wey Don happen na him lead me to where I am today although I no to like am but if sey I come get second chance change something my life come worse I no fit take dat risk na why I no believe in second chances

As u talk am so you know say everybody body get wetin em believe sha

i sabi na

Second chance make brain sha but if na wetin go kill man pikin abeg nor need for half chance talkless of second cha.......

Nah true you talk o my person, nobody won die

Me no get tory talk but since d day wea i enter dis steemit, e don weaken me ... person pikin go post fine pix write nice nice content pesin no go go get upvote .... but me just dey strong cos i do see se ppl dey gain ground for here and very soon me self go gain ground... me just need ppl make dem show me how to catch fish ... so i fit dey catch my own fish tooo @naijapidgin

No worry God go soon pick your call the secret nah hardwork and consistent.

En just be like say Na me get this post,I misbehave with my paddy like that, en come carry en property waka comot for my life.I done dey beg am since this month en no even warn follow me talk,just few hours ago,en come talk am straight say en no wan be my friend again say make I no talk to am again. Abeg my country people make Una help me tell am say I need second chance.
Chai, I Don cry tire.

Brother one way or the other all of us don fuck for this life, thank God you self don reason am say you don fuck up,
And for your paddy I sure say if you beg am well well and you give am small time em go follow you reason am

Ma country people I greet una all oh.... Waytin me I dey reason whey dem give me second chance na my 100l for university walai, people dey talk say na that time pesin fit get the highest CGPA but for my own side I just dey reason say dem just dey talk waytin dey dere mouth......so me I just dey do as I dey do for secondary school I sure say u go sabi dat level nah..... The time wey my eyes go open korokoro result don commot kon dey say had i know I go do better,con dey wish wey dem give me second chance so I fit do my exams again I sure say inno fit be like dz again

My Broda no b small thing Sha if to say many of us for change wetin happen for we 100l e for make sense,
Me nah so Dem carry me go put for department wey I no like o if to say I fit see second chance I for like change am

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.13
JST 0.030
BTC 65702.61
ETH 3485.24
USDT 1.00
SBD 2.51