5 people you need for this your life

in #naijapidgin6 years ago

image

Una good morning, my country people. For this life wey we dey so, we sef need other people to survive. Today, i wan give una list of people wey you suppose keep and no chop their eye because las las "we all need someone to lean on".

PEOPLE YOU SUPPOSE KEEP.

  1. Person wey know everything about you. This kin person fit stand by you and help you take some kin decision wey you sef dey scared to take. Pesin wey go listen and understand you wella.

  2. Person wey understand your potential.
    You need somebody, pesin wey go dey push you to dey do better. Sometimes, pesin go dey discouraged and lost, na that pesin go believe in you and give you better push.

  3. Person wey you fit ball and laugh with.
    Life no dey sweet every time, so any time life do you bad, you need pesin wey go make you laugh. And when life do you well, you need pesin wey you go dey ball with.

  4. People wey want the same thing wey you want.
    If you wan bag PHD abi na house you wan buy, you go need people wey done already do am abi people wey wan do the same thing. Na them go boost your morale if e don dey drop.

  5. People wey dey look up to you.
    Na this kin people go prevent you from failing. They go make you put all your effort for wetin you dey do because you no go wan disappoint them.

So my people, una don hear this one. Find this kin people and keep them, no let them go anywhere. Las las all of us go dey alright and life go treat us better.

Footnote

If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows


Join our discord server for fun, interactions and voice shows here

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

  • Real-Life Talk with @preciousimo
    [Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapidgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain:
@ogoowinner
@zizymena
@oliverwilliams
@horlaide
@mittymartz
@nmalove
@preciousimo
@rosyblessing


Na @mittymartz design this avatar

Sort:  

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! We encourage and support quality contents and projects from the West African region.
Do you have a suggestion, concern or want to appear as a guest author on WAfrica, join our discord server and discuss with a member of our curation team.
Don't forget to join us every Sunday by 20:30GMT for our Sunday WAFRO party on our discord channel. Thank you.

Very refreshing point of view about the type of people we should associate with. Cheers!

#Bigwaves

Congratulations, your post had been chosen by curators of eSteem Encouragement program. Feel free to join and reach us via Discord channel if you have any questions or would like to contribute.


eSteem Line
Thank you for using eSteem

Coin Marketplace

STEEM 0.30
TRX 0.12
JST 0.034
BTC 64058.80
ETH 3150.15
USDT 1.00
SBD 3.99