THE CREED OF LIFE: The Pidgin Challenge

in #life7 years ago (edited)

IMG_20180110_072806_6.jpg

Hi darlings!
I just discovered this contest organized by our very own @ogoowinner and I decided to participate. It is all about translating an English creed to our own Nigerian pidgin english (a popular language we speak asides English in Nigeria).

My Entry


I get believe say everybody suppose make dem see dem, hear dem and like dem

I believe say every human being dey equal.

I believe say this world big to take everybody.

I believe say everybody na ogbonge for one part of him life.

I believe say everybody dey tanda and unique.

I believe say everybody get him own devil and angel inside dem. Me I go try my best to silence the beast and wake the angel.

I believe say d place wey person come from, him God wey him den serve and him money na nothing but Na wetin him fellow human being wan take control am and cause katakata say one person better pass another person. So me I don decide say I go first be human being before I talk about where I come from, the church wey I dey go and the kind money wey I get.

I go make people feel the same way Wen I want make them make me feel.

I no go wicked people because say dem bad but I go show people love like sey dem don be Wetin I want make dem be.

I no go put my hand for something wey go affect my fellow human being.

I go try make I no why people dey do wetin dem dey do instead of to dey judge them.

I no go allow bad mind, pepe eye and big eye, to control wetin I dey do.

I go do something wey good for people life before I comot for this life.

I go try my best to dey gidigba wen bad things and things wey dey make people cry come.

I no go allow fear fear stop me.

I no go allow yeye thinking enter my mind. Instead Na good thinking I go put there sake of say I know sey the things wey dey enter our mind dey very strong.

I go always be myself oh, my original self and no be another person photocopy.

I believe say I fit make things better if I put my mind for anything wey anybody say make I do.

I believe say this our life na journey for road and no be competition, so I no go allow myself enter competition with anybody.

I believe in better place and people .

I believe to dey make people happy.

I believe say make we dey forgive.

I believe in that thing wey we dey call love.

I get believe sey make we dey pity people.

I believe sey make we dey do the same for people .

I get believe in my fellow human being.

I don decide to "live this life" and no be to dey "waka" around.

I @gee1 go dey do this creed all the days of my life.

Thanks @ogoowinner for this opportunity to participate in this. I found it really interesting.

Thank you for reading

Sort:  

Everybody don dey speak pidgin now...that is the power of contest. The spirit is in the participation...good work

Lol... You Don see am na

Madam grace
Lady grace
Boss bae
Super womam
I respect your hardwork and i believe say ur time to blow don reach finish.
Abeg no forget your boys @samson12 and @brightex82 .
U write dis post wella.

Chai... U Don burst my head.
Thank you dear

Boss lady!
You sef sabi pidgin 😁😁

Me sef surprise oh.
Steem it brings out the best in you.

I believe say we go make am and become anything wey we want to become for this life if we believe say Baba God na number one.
Nice one@gee1

Yesssssssoooooo!

Dis one na ogbonge

I like dis your creed so.

E make sense like Gee.

kontinue to dey do am

steemit dey your back.

Lol... Thanks oh. I just dey smile here.

This is getting interesting!

You can say it again.

nice post dear.. check out mine as well. i have upvoted you

Right away.....

Wow @gee1 that's so close to English

Lol... Really?
Did you really understand everything I wrote up there?

This one na ogbonge creed, i don recite am follow join, i dey feel make i no stop the recitement

U look beautiful dearie....nice entry

Thanks dearie.

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.13
JST 0.027
BTC 60308.44
ETH 2640.77
USDT 1.00
SBD 2.54