Pigin proverbs

in #jokes6 years ago

Pigin proverbs? My guy this thing make me laugh like say tomorrow no dey. I dont know the original author of this compilation but it is worth sharing.

I got it from a WhatsApp group chat but na only naija people go really understand am. Anyways, please enjoy

"PIDGIN ENGLISH PROVERBS

Chop this man money, chop that man money, na so ashawo dey start.

Feel at home, feel at home, na so visitor take dey spoil television.

Person wey belle full today, go hungry tomorrow.

Lean on me, lean on me, no mean say make you suffocate me.

Bring Suya, bring Suya, na cow body dey suffer am.

Life be like standing fan. E blow you small, e blow your neighbour small.

Jollof Rice wey dey bottom pot today, go dey for top of cooler tomorrow.

Do you know who I am, do you know who I am, na so traffic dey take start.

Akara and moin moin get the same parents. Na wetin dem pass through make them different.

No be who first call Police dey win the case.

Monkey smart, monkey smart, na because tree near tree.

I dey shame, I dey shame, na so person take dey die in silence.

E no get as e be wey e never be before.

Woman wey dey find pikin no dey wear cloth sleep.

Person wey dey chop egg no know say yansh dey pepper fowl.

No food for lazy man no be for pikin wey im mama dey sell food.

If e reach time to shit, yansh go open.

This one good, that one good, na im make mad man load plenty.

When money dey, friend go dey. When money go, friend go go.

Mosquito wey no dey hear word na im dey follow dead body enter grave.

Use rope tie goat, tie goat rope, na the same thing.

The difference between Kpekere and plantain chips na packaging.

No be today yansh dey back.

You see "thank you", you dey find "very much".

Na village wey native doctor know e dey disappear.

No matter the size of elephant, e no fit cause earthquake.

When breeze blow, fowl yansh go open.

Pikin wey hide cane wey dey for house forget say bush near.

Cow wey rush go abroad go come back as corn beef.

Na the same hot water wey dey make egg hard dey make Potato soft.

Khaki no be leather.

You no go call goat brother just because you wan chop goat meat.

E go land, e go land, na im make butterfly take enter bush.

Na footballer wey ball dey im leg camera dey follow.

Dem no dey beg shit to smell.

To craze no hard, na to trek be the wahala.

Na from clap dance dey start.

Monkey no fine, monkey no fine but im mama like am.

Sun too hot no mean say fowl go lay boiled egg.

Na small shit dey spoil yansh.

Escort me, escort me, na im slave trade take start.

Temper hot, temper hot but e no still fit boil beans.

I no gree, I no gree, na im dey tear shirt.

Dog wey go lost no dey hear hunter whistle.

Na pikin wey no know im mama boyfriend dey call am brother.

Cow wey no get tail na God dey help am pursue fly.

Person wey dey cry dey see road.

Yansh no get teeth but e dey cut shit.

Na person wey wear shoe know where e dey pain am.

Dem no dey tell blind man say rain dey fall.

Second hand suit no dey get trouser.

Pikin wey say im mama no go sleep, no go take im eye sleep.

It's a small world no mean say you go fit trek am.

Na man wey dey reason dey scratch im beards.

Say you chop egg no mean say you don chop full chicken.

Money no dey today, money go dey tomorrow.

Dem no dey find black goat for midnight.

Cunny man die, cunny man bury am.

Na condition make crayfish bend.

No matter as shit big reach, e no fit tear yansh.

I get am before, no be property.

Person wey dey ask question no dey lost.

Who dey cut pepper no dey scratch blokus.

Na sleep dem take dey taste death"

Before cheetah go arrange me him comment make him understand say this proverbs na copy copy o...

Enjoy a fun filled afternoon

Sort:  

Crazy compilation. Lol

This joke has really made my day.
This is awesome.

Thanks man. I am glad you enjoyed it also

Enjoying the Naija pidgin. But understand everything bit of it. Just that Ghanaian pidgin is sweeter than the Naija one.. 😂

Hahahaaaaaa... maybe i will just wait to hear a Ghanaian speak pigin for me to judge. Lolz

Yeah. I can arrange a contest for you

Yeah. I can arrange a contest for you

If at all Ghanaians can speak pidgin,I bet they learnt it from Nigeria

Lol. I know pidgin has its roots from Naija but Ghanaian pidgin is sweeter to me than the Naija one.

I really can't say cos I've not heard the Ghanaian pidgin. I think their accent is what will make it sound sweeter.

E go better e go better na poor man prayer

Seriously this one follow

To listen to the audio version of this article click on the play image.

Brought to you by @tts. If you find it useful please consider upvote this reply.

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.16
JST 0.029
BTC 59696.83
ETH 2363.30
USDT 1.00
SBD 2.55