My Imaginary Description of Steemcurator01 by @ukpono| Written in Ninglish | March 11, 2023

in Steem4Nigerialast year (edited)


steem4nigeria.jpg
Made in Canva direct

Sir @simonnwigwe, shey you dey whine me ni? How I wan take sabi wetin our oga at the top be like? Anyways, anything wey I yarn for this contest, mek you take am laidat mbok.

Eh eh, you know say since I was born, — that's like 20 something years ago — I never take these my two krokro eyes see or smell SC01 anywhere near me. I come begin dey wonder say which day im go come see me, abi na when I don grow grey hair finish, come dey use walking stick, come dey read newspaper for veranda join because me sef no come understand again o.

As I siddon dey think all these things, na im one mind come tell me, “eh, ukpono, you no think say im fit dey busy. You reason am naw. How one pesin go fit dey sit for one place — a throne sef — dey vote plenti plenti quality post everi day like im be one English teacher for Kebbi state? The guy fit dey tired na and as your name fit dey for like 300 and something how you wan make im do?”

As that one mind talk finish, another one para. “Why you talk say na guy? You no know say na only woman fit do that kain shakara. You no see how Itoro dey do. Im go just dey ignore Chiboy anytime dat one come close to am. Before Chiboy fit open mouth say hi, she don catwalk away. Twai twai twai.”

After dem don talk finish, I come begin dey think think think so tey my blood pressure almost wan rise. Na so I stop.


Untitled design.jpg

My imaginary SC01 team
Designed with Canva


Mua thinks say this SC01 fit dey like admin account wey dey managed by plenty plenty trustworthy people — oyibo o, African, man, woman— all of them join. Today, Titi go handle am, for afternoon na Wale, for evening Tonto fit dey around. And dem dey strict. Dem no dey like carry nose smell any post wey no dey quality.

For me, I think say e dey good laidat. By having a representative from every demographic group, e fit kill favouritism pankquem. You know as our brothers from above dey say, “absolute power corrupts absolutely.”

Anyways, anyhow e dey be, mek im be. But I get message for our ogas at the top.

SC01, I know say una go see this someday.
I wan make una know say that na una be my Odogwu — all of you. Anything wey you talk na im I go do.
Na only your word be my command
In case you bin no know, na your ododo dey fulllll evediwey o.
Who dey zuzu!
Who dey breet!
SC01, Odogwu international, akwa obongawan
Biko mek you show us big love na.
The streets wan use us play Poker
Boys and girls still dey hustle for daily agege bread and mama nyeti beans o.
Na you we dey look up to now o.
Abeg, show us love. Bikonu. Thank you.

@davidmarkgeorge @sikan-eyen @nsisongudofia, una no go come join me dey hail am now. Abi una dey fear? Okay, just dey play. If this container land laidis, na only pesin wey support me wey I go remember.

About Me | 10% payout to @steem4nigeria | Proudly Nigerian🇳🇬

Sort:  

I should show you a picture of my ribs being cracked out 🤣🤣🤣
Pidgin English is nice and especially on a case study like this...
Omorr dem no yarn you well oo..shea dem be your odogwu

Much love💕..
Thank you for inviting me

Congratulations!
This post has been upvoted through steemcurator07.
We support quality posts anywhere and any tags.
Curated by : @lhorgic

TEAM 4 CURATORS

 last year 
Thank you, @ukpono for participating in the contest in the Steem4Nigeria community today. We have accessed your article and we present the result of the assessment below.

CriteriaRemark
Verified user
#steemexclusive
Free of Plagiarism
#Clubclub5050
Bot free
Voting CSI5.4 ( 0.00 % self, 44 upvotes, 33 accounts, last 7d )
AI Content Generated free
Grade8/10

  • Reviews: I love your style of writing. Don't worry, one day you go use ur korokoro eye see 01 for your post, just improve on your post, and remain consistent.

Thanks for the review, @ruthjoe.

Just got informed a few days ago that I'm currently in club100. I didn't make the necessary corrections earlier but I will do that now.

How can I improve on my post, please?

What areas should I focus on?

I am looking forward to reading your response. Thank you in anticipation.

 last year 

Noted...

You can improve on your post by learning markdowns..you can start by finishing all the achievement task.

Thank you

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.12
JST 0.032
BTC 66938.10
ETH 3118.64
USDT 1.00
SBD 3.81