STORY FOR THE GODS

in #writing6 years ago

girl-147105__480.png
Source

Shey you don do your own na, shebi you don talk your own na. No wahala, shebi I resemble mugu na, abi I resemble mumu, I no geh sense na, shey na so your life be?

You just wan play with me finish, then drop my heart na, make e sink for the water of wickedness wen dey your heart. Na like this your life be? Na like this you be? Na so your life be, why you nor just tell me say you nor want, you just dey like winch wen no go let person go, you sef no go let the person stay, oh boy wetin you want sef?

See I know say I love you, but I nor be fool you dey hear me? I nor be idiot, I get sense and I know sey you geh babes everywhere for area, evn the ones wen nor dey here. Ne just because my heart be as en dey, because the day wen I go decide say I nor go do again, no beg me, no ask for my attention oh becaue if I lock my door na final.

Bros, I don do everything, I don tire, I dey go abeg, the kind life wen I want live na steady one, no be games, I don tire for your games, I don tire to be the babe wen dey straff you, I be your friend oh but I don tire for the benefits you dey add wen dey only benefit you.

So this na my last gist with you, e don hook me for neck, I don tire to dey hear your story for the gods.

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.16
JST 0.031
BTC 61092.62
ETH 2666.59
USDT 1.00
SBD 2.62