LAUGH WAN KILL ME OOO!

in #vigion6 years ago

LAUGH WAN KILL ME OOO

Dem say Boko Haram don poison beans after I buy half bag for house.

From the one wey I cook, I give my dog, Bingo, make im first test am.

45mins later, bingo still dey waka, dey jolly. Na im I come chop my own.

After I don chop finish, my gateman run come tel me say bingo don die.

Hey! I run enter house, begin drink full gallon of palm oil for my belle, chop 22 bitter kola wit 3 long bitter leaf stem, chop walnuts with the shell no time to crack, swallow moringa with aloe vera as treatment combo. Garlic and onions be like sweet for my mouth.

I come dey sweat as if na oven be my bedroom. I dey think say my life don finish. I come outside.

Na im gate man com they tell me say the driver wey kill bingo wan come beg me!

If na u, wetin u go do the gate man? ????

Pls don't laugh alone.....
😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.12
JST 0.032
BTC 59940.43
ETH 2988.79
USDT 1.00
SBD 3.61