Unexpected Proposal wey burst my brain

proposal picture.jpg

Naso one girl wan nearly fuck him guy wey propose to am today up ooh,naso the thing shock me because i think say the girl no go accept because of the way wey she take behave.

I Greet una happy sunday oooh, i just say make i tell una wetin i witness today for ife here oooh.
After wey i come back from church today , na him me and my oga's for steemit, people in the likes of @gbenga, @illuminatus, @bat-junior, @musteethany, @olamisexy, @hormorhk18, @steve1122, just enter covenant orphanage home for moro in ife go shower them gift say make we go give them some things from wetin GOD don dae bless us with through steemit.
Those children wey we go give gift happy sote them they pray for all of us and the remain steemians, and after wey i commot for the orphanage house na him i just say make i reach house sleep.

He never reach 30 minute wey i wan sleep na him one of my friend call me say make i come meet am for ife and i come tell the guy say i dae come.
As i reach ife na him my guy say make i enter one place wey dem dae call captain cook , naso me self package myself as a big boy now enter the place, but when i enter the place the kind settings wey i see burst my brain and i come ask my guy say na wetin dae happen say we no dae xmas again now, naso the guy tell me say one surprise thing wan happen for there now, i come dae ask him say wetin be the surprise but as i look to my right i see some people wey just sidown dae gist and some people for one side and one of them dae play guitar, na him see one fine boy wey sidown wey carry cake for hand na dem my brain come work say na propose the guy wan propose.

         After some minute na him the wife to be enter dae ask her friend say where her boifriend dae and dae come tell her say the guy dae the other side and as she enter like this na him the guy kneel down with the cake for him hand telling the girl say shey you go marry me, and wetin we see be say the girl just dae laugh and she no say anything, and the next thing wey she go say be say shey i ask you make you propose, who tell you say i don ready to marry now, everybody wey dae there dae shock because we no expect am, na him the guy start to dae cry say hin done enter one chance.

         Na hin the girl just look the guy say next time no dae do something like this again say him suppose don tell her say him go propose, na him i vex comot for the place say the girl no serious but before i reach the door na him the girl shout yes ! yes!! yes!!! i will marry you.

Propose-to-a-Woman-yes.jpg

Thanks for reading.

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 61830.18
ETH 2457.48
USDT 1.00
SBD 2.54