Oya Come Make We Go!

in #ulog6 years ago (edited)

My people, how una dey inside this chilly afternoon? Yes o, cold dey well well for PH now because heavy rain dey fall and na so my colleagues just dey find one place to kak, lol na sleep I mean o.

Today start well sha, I comot for house at about 8a.m and I know say I bin don late for work again, but na so today own just be. Thank God, I still reach work on time sha.

So as I reach, e come be say na me be first for my department to arrive office today. I come dey happy ehn. Na so I take pictures as I dey climb the stairs

IMG_20180629_084639.jpg

IMG_20180629_084657.jpg

Yes o, today na Friday and na native attire I decide to wear. Na big sister bin buy the material once once like that when she follow bush cross border. Haha. So I still dey enjoy am sha.

As my team leader come arrive na, im talk say we need to prepare 15 systems for TOEFL exams wey suppose be tomorrow. Na so we start work o. As we log in the online server for TCA's(TRAINING CENTER ADMINISTRATORS), you know wetin we see? Dem don comot the allocated number of students wey suppose write exams tomorrow. We come dey confused, na so we say make we call our MD , tell am wetin dey. She come confirm say true true, exams no dey tomorrow. Only me know as my belle sweet me. No be say I happy sha o. But at least I come use that time learn small photoshopc6 .

Break time later reach, so I don dey buy Coca Cola sprite drink all these days, I say make I change taste today. No so I come buy this drink.

IMG_20180629_145011.jpg

Na so my friend Mr @alextiman come dey laugh me say I dey deceive myself with watermelon drink, say na fake. I come dey drink am with fear o. But last last, my money no go waste naw. So as I chop finish, I come dey feel stronger coz I bin hungry well well.

Na almost 5pm, and officially I suppose close by 5pm but rain come dey vex pass before. So na to wait na im I dey so. Meanwhile, make I dey enjoy this amazing masterpiece by 2baba ft Sauti Sol - oya come make we go. But I no dey go for this kind rain sha

IMG_20180629_165327.jpg

IMG_20180629_165320.jpg

IMG_20180629_165254.jpg

Una thank you o!
Na still Mr @essiential be my name , only say I sama una with pidgin English language today.
Mr Terry aka @surpassinggoogle, I troway salute o.
Na my #ulog be this today..

Sort:  

Super nice your no 1

Ulog tips, read here:

More tips:

What is Ulog?

Thanks for these useful tips. Will definitely play by the rules from now on.

Coin Marketplace

STEEM 0.29
TRX 0.13
JST 0.033
BTC 63252.23
ETH 3035.50
USDT 1.00
SBD 3.73