NAIJA COMPANIES DON SHUT DOWN

in #steemit6 years ago

My pipu, my pipu how your body, and how everything dey take be?
Una good morning, as we know say today na another work day wey hustle go start after una don jollificate for weekend, well na plenty plenty favor go circulate am.
@NAIJAPIDGIN dey wish all of una a stress- free week, Amen.

IMG_20181008_062340_970.jpg
Source
The mata wey we carry hit we blog this morning be say 'majority of we naija company don shut down', as fact, 800 naija companies don go off work between 2009 and 2011 wen naija economy still beta (according to ministry of commerce) as I dey see am like this, the companies go don multiply by 10. Everywork dey outside dey shout for work, how work go dey when companies wey suppose dey provide am dey shut down every day.

Reasons why companies dey shut down?

  • Government policy: I know say una don dey intersted, the case be say, our naija company dey put outrageous sum of money as tax for companies wey neva grow at all, as a mata of fact, we the company see say dem no fit afford the tax, them go shut down.
  • We no dey buy home goods : This one na one major thing wey we dey do, I sabi on company for Ekiti state wey dey do 'tissue paper', due to its kain quality and high price, pipu no dey buy am but them go buy the imported cheap ones, maka why?
  • Some companies no get skilled labour.
  • Government self dey carry their hands close companies bcos of political agenda.
  • Economic instability : As some investors don see say our economy no stable, them don pack their loads.
  • Security self no dey.

Problem wey companies shut down don cause be say dem go send away dem workers and no other opportunity go dey their again. And them dey also amputate we country economy growth

Possible solutions to companies wey don shut down.

  • Government fit provide funds for some company to operate as dem don close down due to money problem.
  • They suppose reduce the tax wey dem they put on developing companies.
  • Them suppose provide qualified training for pikin companies.
    My ogbonge pipu, I think with all this, I don gather a point,
    You fit add more for we comment post.

If you like what the community is doing and would like to support us,

Please follow our trail via
Or delegate SP to @naijapidgin.

We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows

Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On @naijapidgin discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON

  • Every Tuesdays we have real life issues with @preciousimo
  • Every Wednesdays are unavoidable lectures
  • Every Thursday we have relationship talk with @sparkles
  • Fridays is our well known ameebo center by @rebeccafl
  • Sundays is always variety night show by @itoroarchibong and @imbigdee.
  • Same Sunday we have our @naijapidgin hotseat ( featuring some well known steemians)

You ought no to miss any of our programs.

TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|

IMG_20180319_092844_398.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

This one na big matter for

But Las Las Nigerian people go survive

Humm
Na only God go help us for this our country oo

Una weldone oo @naijapidgin

Coin Marketplace

STEEM 0.29
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 62934.09
ETH 3118.65
USDT 1.00
SBD 3.85