SMARTCASH VS OTHER CRYPTOCURRENCIES

in #smartcash6 years ago

My pipo una wedon ohhh!!! For dis post today I go dey yarn una about how Smartcash take beta abi as onyibo man take call am "outsmart" other cryptocurrencies dem.

Block Rewards

smartcash dey give dem miners dem(dis na pipo weh dey do de coin for dem community )5% but coins like dem dash dey give dem own 45% .chaiii.

Smart Rewards Nkoh

dis ogbonge community dey give dem Pipo weh get wetin dem de call smartnode(up to 10,000 smarts weh be about 500k for Naija)15%but dash come pack 45% dey give dem pipo weh get masternode(upto 1000 dash weh dey about 176 milla omoh did one na big money ooo).una see say Smartcash no dey do wuruwuru dem no dey do magumagu dem dey make sure say everybodi for dem community dey collect.

Smart Hive

Dis one na de wan weh dey totori my belle na him dem dey call smarthive. Asin ehn I Neva see any oda coin dem weh dey show concern for dem community like Smartcash, dem pack all de 80% come chook for here dem come share am give 24% give dem hive team(dis na pipo dem weh dey work for dem we dey oversee the development and make sure say de coin for grow wella dem come give de rest of the 56% for community budget na inside dis money na him dem dey take fund proposals come dey even take help community wetin dem call am na community service ehen like dis one weh dem dey do for dis onyibo country Venezuela weh dem call am food distribution in Venezuela).

toh until my next post wen I go come wit more ogbonge reasons weh make Smartcash beta pass de rest dem but for now don't forget to like, comment and esteem please. ![images.jpg]()

Sort:  

Keep up the great work.

Sure!! Thanks

Σ$$$ Tipped @aboiblessing Σ30 SMART! Comment @smartbot help to claim. Currently the price of SmartCash in the market is $0.122 USD per SMART. Current value of the tip is $3.66 USD. To find out more about SmartCash, please visit https://smartcash.cc.

Congratulations @aboiblessing! You received a personal award!

1 Year on Steemit

Click here to view your Board of Honor

Support SteemitBoard's project! Vote for its witness and get one more award!

Congratulations @aboiblessing! You received a personal award!

Happy Birthday! - You are on the Steem blockchain for 2 years!

You can view your badges on your Steem Board and compare to others on the Steem Ranking

Vote for @Steemitboard as a witness to get one more award and increased upvotes!

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.16
JST 0.032
BTC 58630.84
ETH 2465.03
USDT 1.00
SBD 2.38