HUSTLE GO PAY ONE DAY! A POEM IN NIGERIAN PIDGIN ENGLISH!

in #poetry6 years ago

imageIMAGE SOURCE


E don tey wey man dey wait
E don tey wey wait dey wait man
Dem say patience na true virtue
All these things dey look untrue
10years person dey fry akara
From January to December e dey tie wrapper
E never still think to open restaurant
Even mama put no get store front!

E don tey wey man dey wait
E don tey wey wait dey wait man
Boys go dey smoke for one corner
Something wey be heart burner
Babes hustle na to waka naked
For their tiny mind fashion upgraded
Man no get peace of mind
Street no get watin we dey find!


E don tey wey man dey wait
E don tey wey wait dey wait man
Gunshot up and down for area
The only thing wey we get cure na malaria
Even your house na public affairs
Your neighbor food dey break your night mare
Joy dey or no dey street
Finally we no even fit chop meat!


E don tey wey man dey wait
E don tey wey wait dey wait man
Poverty dey hammer us
But we still dey carry shoulders like boss
Them dey burst bottle up and down
Street boys still dey fight for crown
For infertility them dey bargain
Price wey no waka with better gain!


E don tey wey man dey wait
E don tey wey wait dey wait man
He who laughs last na stammerer
Forget that thing people still dey hammer
Bad things fast pay pass good
Boys still dey loyal to the hood
Poverty no fit shake us to say
Hustle no go pay one day!




This write-up titled HUSTLE GO PAY ONE DAY is a poem written by me in Nigerian Pidgin English. This poem has 5stanzas and each stanza comprising 8lines with a rhyme scheme of ABCCDDEE all through each stanza.

imageIMAGE SOURCE

Generally the poem is a mission to state the velocity of hustling in the street and the hope for one to 'make it' despite the difficulties and infertility of the street.

I hope you enjoy this piece!

I am Itoro Archibong and a pen addict! 📝📝📝

Sort:  

Wow!!!
Itoro i must confess, this is beautiful!
I think i'm seeing a pidgin poem for the first time and it awesom.
Thumbs up baby, our hustle go soon pay
👏👏👏👏

Thanks Dear. Our hustle will definitely pay soon.

Yh bro; hustle go pay one day
the write-up depicts reality, no fantasy or daydreams that's what I like about it and the fact that its in pidgin alone is mind blowing

Thank you so much. Most times we need to come back home and represent what we stand for.

Congratulations! This post has been upvoted from the communal account, @minnowsupport, by itoroarchibong from the Minnow Support Project. It's a witness project run by aggroed, ausbitbank, teamsteem, someguy123, neoxian, followbtcnews, and netuoso. The goal is to help Steemit grow by supporting Minnows. Please find us at the Peace, Abundance, and Liberty Network (PALnet) Discord Channel. It's a completely public and open space to all members of the Steemit community who voluntarily choose to be there.

If you would like to delegate to the Minnow Support Project you can do so by clicking on the following links: 50SP, 100SP, 250SP, 500SP, 1000SP, 5000SP.
Be sure to leave at least 50SP undelegated on your account.

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! We encourage and support quality contents and projects from the West African region.
Do you have a suggestion, concern or want to appear as a guest author on WAfrica, join our discord server and discuss with a member of our curation team.
Don't forget to join us every Sunday by 20:30GMT for our Sunday WAFRO party on our discord channel. Thank you.

This post has been selected by Altruistic as a post of the day has been given an upvote.

You can join us on her discord server: https://discord.gg/KHB9eJk to know more about what we do and how we can be of help. To earn more curation reward, you can follow our trail on steemauto.com or streemian.com and use Altruistic tag: altruistic-steem

altr-banner.png

Please kindly upvote this comment in order to keep us helping plankton and minnows that their quality posts are undervalued.

Coin Marketplace

STEEM 0.26
TRX 0.11
JST 0.033
BTC 63811.67
ETH 3092.68
USDT 1.00
SBD 3.86