THE CREED OF LIFE #npc by ogoowinner. AS LIFE SUPPOSE BE

in #npc7 years ago (edited)

image

Na better yarn say everybody get right make people notice them and make them yarn make people listen

Na better yarn say na from woman all of us comot so we be the same all these long leg thing no suppose dey come up

Na better yarn say this world e reach us remain. Stay your lane make the other person stay him lane.

Na better yarn say all of us get our area where we for dey shine

Na better yarn say if you do anyhow you go see anyhow cos yanga no fit dey sleep make trouble go wake am and kasala no go burst. Everybody get e own craze for body

Where you from come and wetin person dey serve no reach to make us divide. E no suppose matter where you come from or the church where you dey go.all of is na human we be and na so I don decide to see everybody

I don decide say na as you take me na so I go take you for this life wey we dey so. I no go use my hand pour sand for person garri.

I no go be rat wey dey chop person dey blow am breeze.

As goat take stand for market na so them dey price am so as you take present yourself na so I go follow you.

Even if shigba no gum me I go Tanda for there because I know say tomorrow go better.

I no say our mind get power so I go dey tune am make e dey reason only better things

I no go be copy copy. Na tear rubber I go be .

Na pure yarn say me fit change this world if I put my mind for am.

Love na my second name

Peace na my mama name

I no go dey carry person for mind

All of us dey equal so na wetin Dem do Peter na im dey go do Paul.

I no go just come this world come die make people no notice me. I go show myself.

I Orezimena Faith don talk say na so I want they live my life now.

Thank you @ogoowinner for this opportunity wey you give us so.

Our own Stephanie Okereke Linus na im dey the picture
Picture na from igbolive.com

Sort:  

My sista u try weh weh for this one

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 64574.81
ETH 2639.22
USDT 1.00
SBD 2.79