Nigerian pidgin challenge #3 by @ogoowinner

in #npc7 years ago (edited)

ZomboMeme 27012018223623.jpgI dy hail una from d oda side. Ds na my entry for d pidgin challenge by @ogoowinner. Anytym I comot for bed na in I go talk all ds tins before I comot for my fucshon
picture of Mr Ibu from memegenerator. com
picture of Ay from memegenerator. com

For my mind I sure say everyone get right make dem get love from other persons, make people hear wetin dem talk, make people dey see them

I believe say nobody big pass en nebo

For my mind, I sure say ds world we dy big reach to enter evri person

I believe say everybodi dy special con get sometin wy be say only am get

For my mind, I know say everybody wey you see get jaga jaga side, come get beta side join. Na en mke me talk say I go use all my power comot dt bad side kpata kpata con make sure say wake the beta part wey be angel
ZomboMeme 27012018224036.jpg
I belief say person colour of skin, how you take dey serve your God, and whether you rich or poor for life no mean anything except say some kind wicked men wan use am control others, cause wahala (or kata-kata) and on top this dem wan make other people feel say them big pass others. So first first, I don choose say before I be black or white man, before any way I dey take serve my God or whether I dey rich or poor for life, I be person wey God create like im create my fellow pesins

As I wan mke pesin do me for bodi, na so I go treat am back

I no go adres pesin based on who dem be, lie lie.. I go adres dem based on who i wan mke dem be

I no go do wayo business wy go do oder pipl strong tin

I go try well well mke me and person relate mke I no go cary bad eye for am

I no go gree mke bad belle, big eye and jelosy control anytin I wan do for ds life

Before I kpai, I go do one kin beta tin for ds life wy i find mysef

I go try wella, bone face no shaking wen bad bad tins full for my side

I no go gree mke bad bad tins full my mind, I go comot mind for dose bad bad tins con put beta tins for en place, cos as u see me so, as I begin reason those sweet sweet tins, na so my lyf go dy beta

I go be myself, only me dy as I dy for ds life u see so. I no fit copy person character

If to say I put my mind say I go chnge plenty tins.. I know say I fit do am

I believe say ds life no be by who finish first so I no go gree mke me and person start to dy drag who go mke am first first

I know say peace fit reign
I belief say pipl dy give
I belief say pipl fit comot eye if u do dem strong tin
I belief say two pipl fit dy die for derself
I belief say ds tin we dy call mercy dy ds world
For my mind, I know say justice dy
I belief say we be one body, one race
I don mke up my say I go enjoy my life, ds my life, dy no born me mke i just sidon one side

I, yudee go follow all ds plenty plenty tins wy I don talk till I comot for ds world
Picture of Mr IBU and Ay from memegenerator. com

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.13
JST 0.026
BTC 58961.27
ETH 2500.29
USDT 1.00
SBD 2.45