Friendly enemies

in #npc7 years ago

images-1.jpg

I want to thank you @ogoowinner for the opportunity giving to me to partake in this contest. Indeed their are friends and their are friends.
Here is my entry.
The tori wey I wan tell una pain me wella cos I no dey expect am from the person wey do am to me.
E get a time wen I wan buy motorcycle and my money never complet na so I go to my friend wey we dey do thrift together to give me the money make I use am shapperly since e b say na en turn we dey, and he done talk am say he never need the money for now. To cut d tori short, my friend tell me say make I go collect the money. I then borrow money from a neighbor tell that one say I go give am by evening wen I get the thrift money, that one com yan say he go need the money by evening ooo, I com tell am say make en no worry, for en money go dey ready by evening,i com collect the money use am to buy the bike. When I get to the place where I suppose to collect the money,they yan me say my friend don collect en money. I com think say he help me to collect the money since e be say na en turn. I com call am say wia en dey make I come collect the money, my friend com yan me say make I no vex that e done use the money. My head just dey doing gbanganunnn,as I no no wetting I go tell the person wey borrow me money.
If not for my brother wey bail me out, I no no wetin for done happen.

Thank you for reading through,my pidgin is not too sound, but I have to do it this way... Smile
Una well done oooo, my people for ogbono naija.

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 58239.61
ETH 2287.71
USDT 1.00
SBD 2.50