NAIJA PIDGIN CHALLENGE: FRIENDLY ENEMIES

in #npc6 years ago

My Country people una doh oh!
Before I tanda ontop this talk-talk mata today, I for lyk troway salute give d lovely shenkehs wey arrange this package put so. @Ogoowinner you too much eh, make baba God bless you for all we people wey you don hep dia career so.
Ehen! Today, I wan tell una one pure tori about how pesin wey I tink say na my padi, chuk hand for my eye sake of say I no reach.
No be small tin oh... E don reach lyk 5 years now wey I for take know this guy. He no been get wahala at all dat year, infact eh, if no be to say na man him be, I for dey reason one or two... No tink am.😉
Back in dat year sha, dis guy been reason me say him for lyk make we for stay together onto roommate mata. Me I no bee get issues with d plan, in short eh, na exactly wetin I tell am be dat. Reaching time for rent payment, tinz cast for dis guy sake of say im papa kpai.
As a guyman, I reason my guy him own part of d rent money plus oda tinz wey we been need dat tym; evritin been dey my head. E no been easy at all, I no go lie.
Na dis part wey I no want make una mix up: I no been dey do any of dis tinz with d mind say dis niggy go pay me, you grab- na just guyman level I been dey on.
After some years now, this guy come grad and one of him papa padi sign am up sharp-sharp. In less than no tym, my guy come dey chop up. The mata gimme joy.
Just last week, I jam this guy for one of our guys party, dis ma guy don dey mob eh! D ride too go me well, I no fit shout. With dis sweet mind, I waka say make I go hail my man based on him doings na as e be say e don tey reach lyk one year since we last talk.
E go shock u wetin d guy yan me. He talk say, I don come now as I see say pepper don ripe, I wan come chop. He even talk say him don dey observe me since say me, I be gold digger...
Till today, my country people, I never still recover from d shock. Some people just get am for body sha.

Make I end am here now abi I neva try. Na so e be. Make una jollof, I don waka.
fake-friend-quote-mask.png
Source

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.14
JST 0.029
BTC 64063.06
ETH 3144.15
USDT 1.00
SBD 2.55