Make una come follow see why i like steemit o

in #npc8 years ago (edited)

Da, omoh mehn the stori sweet die. De reasons e plenty eh. But before i start to de talk, make i cocoma tell una who i be...my veri close pals de call me Ade Bisi. I no from igbo come o, I be Akwa Ibom babe. But i fit find your trouble well well.
BeautyPlus_20171210161343_save.jpg
That na my real face, no make-over.

Oya make we de go de main ting where carry us come here today

All those ponzi schemes wher @ogoowinner bin de try analyze no be small ting o. De way that ting take drain me, till today e de be like say person pour me jaz collect moni. But i wan use this opportunity thank @nedi and all de pipo where join hands with am bring this platform, because e don deliver me from shock.

Another thing be say steemit e don change my levels, oboy i de look fine anyhow. I no de ask my people for any money again in fact i de give them. E don promote me for my family sote dem de respect me because naw, I de follow contribute make de family grow.

E no finish de o, steemit don do make i get money de follow pay other people school fees, all de small small children for my area where dem been de pursue them from school anyhow, d story don change because i de even pay before term resume give them. E de gimme excess joy.
IMG_20180114_155451.jpg

If i wan de list de list de go, una fit sleep for here cos e plenty well well. Day go dark, break again una go still de read de go. So make i pause my testimony for here.
Make i post link of this contest here, make una follow participate.
https://steemit.com/npc/@ogoowinner/naija-pidgin-challenge-make-una-tell-us-why-una-like-steemit

Ah i been almost forget, abeg no just read go, upvote am uhear. then go do your own.

Sort:  

you try well well; I troway salute for you.

Thank you dear

Ma sista steemit na de way forward oooo
Ah hapi say me self don follow join steemit as e be say small time my stori go change

Betta still dey come wella for us for dis platform wey we gather dey

What exactly will be won from the contest?

Coin Marketplace

STEEM 0.08
TRX 0.30
JST 0.035
BTC 110330.25
ETH 3876.44
USDT 1.00
SBD 0.52