I believe - the creed of life. Nigeria Pigin Challenge Contest by Ogoowinner.

in #npc7 years ago

This one nah creed of life oo. Wetin you belive say you go dey do for all your life.
I just dey thank God for our sister @ogoowinner who make me enter another edition of Nigeria Pigin Contest. I pray say make baba God bless am better and keep am. Maka why? She don bless life from #npc

THE CREED OF LIFE

I believe say everybody get right make people see'am, hear'am and love'am.

I believe say every human being dey equal.

I believe'am say de world fit accommodate everybody because say it big well well.

I believe say everybody get one thing wey he be baba for dis life.

I believe say everybody dey special and different

I believe say everybody get character wey bad like demon an get another wey good like angel. So I go make sure say I kill the one wey bad an show people the good side.

I believe say people body color, religion and level wey dem dey for society no be anything, na just wetin men wey dey sellfish dey use control odas, cause wahala and make people think say them be oga . nah why i accept say make I be human being first oo before i come dey call my people, religion or level.

I go dey treat people dey way I go like make dem treat me.

I no go follow people dey yarn becus of wetin dem be but becus of wetin I wan make dem be.

I no go follow do business or anything wey go cause wahala to give people.

I go try make sure say I no judge people, but na understand dem.

I no go allow envy, jealousi an greed control wetin I dey do.

I go make sure say as I don come dis world I go do one beta thing wey go helep everybody before I go comot for dis world.

I go make sure say I dey strong even wen things dey good an wen e no dey good.

I no go allow fear make e hold me.

I no go allow anything wey dey bad come dey my mind, I go make sure say anytime wey bad thing wan enter my mind, I go replace'am with good one immediately, becus I no say something wey dey person mind get power oo.

I go be me, an no go copy people anybody.

I no say I go do beta if I hustle wel wel for any work wey I dey do.

I no say dis life na jeje, no be fight, so I no go follow anybody fight becus say life nah jeje

I believe in peace.

I believe in helep

I believe forgiveness

I believe in love

I believe in mercy

I believe in justice for everybody

I believe in people

I don decide say I go live no be to just dey exist.

Me wey be @untalentedwriter go follow dis creed till dye day wey I go comot for dis life.

May God help me sote..

IMG_20180128_115955.jpg
D image nah Okpara Square Enugu.

Nah still @untalentedwriter.

Resteem; Upvote; still remember to drop a comment

Coin Marketplace

STEEM 0.15
TRX 0.12
JST 0.025
BTC 55515.17
ETH 2501.35
USDT 1.00
SBD 2.30