NPC; BLOCK BUTTON, NECESSITY -ADD PLEASE.

in #npc7 years ago

IMG_20180209_081328.png
[Zoro swagbag]

I don reasonam sotee, na so the thing come wake me this morning. Me i join now, i wan talkam as e dey pain me.
Facebook matter even fit carry person wey you no even know come dey know your door dey request for friendship. Me sef enjoy whatsapp pass o. Whatsapp na em lock door pass. You don forget say you fit carry new number take open new whatsapp and na only person wey get that new contact fit get you for em whatsapp list?

Yes nah. If you no come give anybody your new contact the person no go come trace you, rather you ma fit they see am for your list but em no go dey see you. Na em be say na when you carry your hand chat am na that time em go get you for em list.
So you fit use that way sef choose people you wan dey yarn with and comot face for others.

Me ma i be omor naija. Wetin dey bother my sister @ogoowinner dey worry me for here too.

Abeg make them ADD the BLOCK BUTTON sharp sharp make man no come dey spoil things like that. Me I get single bone like this o. Oyibo make una no talk say we no talk am o. I don finish

Abeg i dey send My apprecition make em waka dey follow @ogoowinner, @destinysaid, @gbenga, @ehiboss, @uniquegem, @setapart because as a newbie for the @naijapidgin matter, I come jeje the survey the environ, i come dey see say these people we i call their names don dey work hard for we naija steemians and me i no go dull lie lie. I wan follow make our @naijapidgin agenda dey go forward sharp sharp.

I hail una o.

My name na still @uniqueknowledge una himble brother. I salute you @ogoowinner for your hand work.

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 57889.68
ETH 2457.18
USDT 1.00
SBD 2.40