My NPC entry for today: Wetin friendly enemy don do me

in #npc7 years ago

My countri people, una wehdon o.. Mek I Kukuma throway salute give my madam @ogoowinner say she too try Abeg.
This tori wer she don cari con so many the kind yan wer fit change am for person o.
E get people wer I dey hear as dem go say

na my bestie be this

Mek i yan una my tori

images (1).jpeg

Ibom Tropicana, Akwa-ibom state, uyo: source
As nigga wer I be, I dey cari wallet waka go anywhere I dey go incase I go pour person oil for market mek I no con Waka with boxers go house.
I waka from my apartment enta school one Friday morning, as I reach school lecturer don teach go far. I rush sidon for back dey find way to copy the note wer I miss as I con late.
After the class don finish, I kukukma dey go bk house, as I reach house I say mek I go withdraw small money my people send gimme mek hunger no kee me.


As I wan dey move, I check I no see my wallet and my ATM card bin dey inside am. I check the whole house tire, I no see am. I even con dey try track my movement from morning to see if I go fit remember wer e miss. Naso I con remember say I enta class with am. I con call my roommate ask hin say him no see am. As hin even hear am laidat hin con follow me dey check for am sef because say dat moni wer I want go withdraw so, na it we bin suppose carry tidy food.
The thing con dey serious becos none of us bin get any moni to carry chop and na weekend be dis so. I con trek enta school go dey check everywhere wer I bin enta before as I con class. I no see that wallet again so e no get how I go fit withdraw the money.
I just enta compulsory fasting till I bin fit see person wer I go borrow moni mek we chop. Mek I cut the long tori small. I don go bank go collect another ATM card even forgot the money wer bin dey the wallet until one Saturday as I dey do sanitation I con see my wallet for my roommate box, omo fear catch me like goosebumps and I even con see say my friend wer I don sabi from secondary school don chop my 4k wer bin dey inside go far.
I just leave am mek I no con get wahala with am because of money.

I don learn say no be everybody wer follow you smile be ur real friends.

© @ungest

STEEMIT-BLOGGERS-GIF.gif

DQmQ599LwdiqJJw5oko4MK4PHcPJCZkvk8ScrW9ojcJfGX9_1680x8400.png

Animated Banner Created By @zord189

U5dr2k4hZ7ea2JFR1osnR5L9hkKVUJu.gif

Sort:  

@ungest
Your publication has been successfully shared, with more than 2421 Steemit users thank you for participating in the last edition of free reestem.
If you find my project useful, donate a vote to my comment

The @OriginalWorks bot has checked the text of this post and it appears original!

ezgif.com-resize.gif

To call @OriginalWorks, simply reply to any post with @originalworks or !originalworks in your message!

Please note that this is a BETA version. Feel free to leave a reply if you feel this is an error to help improve accuracy. Please note, it only checks the text component!

Up vote my post too

ehya can imagine the feeling,e fid make person cry,my own don miss like dat sef,my purse,wei money i don withdraw dey inside oo,na so so cry i dey,y e b dat time wei i just go withdraw...e no easy my dear

E no easy oh... Shey na sometin dey do person mek e sabi body sha

lol.. You for kukuma call me na.. I for send you cash immidiately @willizgallery

haha, i bin cry ehn, i just go withdraw na ein pain me pass

Congratulations! This post has been upvoted from the communal account, @minnowsupport, by ungest from the Minnow Support Project. It's a witness project run by aggroed, ausbitbank, teamsteem, theprophet0, someguy123, neoxian, followbtcnews, and netuoso. The goal is to help Steemit grow by supporting Minnows. Please find us at the Peace, Abundance, and Liberty Network (PALnet) Discord Channel. It's a completely public and open space to all members of the Steemit community who voluntarily choose to be there.

If you would like to delegate to the Minnow Support Project you can do so by clicking on the following links: 50SP, 100SP, 250SP, 500SP, 1000SP, 5000SP.
Be sure to leave at least 50SP undelegated on your account.

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 58239.61
ETH 2287.71
USDT 1.00
SBD 2.50