Naija Pidgin Challenge. How Steemit take dey sweet me for body

in #npc7 years ago

Area! Area!
image

My country pipul, I troway salute Una oo.
I know say una dey flex una weekend pass phone flex and the way wey Steemit dey show Una love. E dey do Una jigijigi for body abi.

As e dey hot, before I begin Yan una Wetin dey my mind today, I wan first fes comot cap, do press up for our mama whale wey be @ogoowinner who say make we write how Steemit take dey totori us for body for this challenge wey she call #npc. Abeg make Una help me carry this basket of "Thank you" give her for the things wey she dey do for us wey be JJC (newbies) here.

So now as e dey hot, I no want hear say dem shoot bird, him mama no fly so make I sharperly Yan una want tell una,Why I like Steemit as e dey hot. E don too sweet me, so they I dey look like sweet potato.
image

The first area wey Steemit take dey sweet me for my medulla oblongata na for money. Since wey I join Steemit, I no dey lack money again. Even my friends Fey even call me young Billi. Before I be dey chop Zero zero One but now, I dey chop like say I be whale. I don dey live like those yahoo boys wey I dey hear for radio and I dey chop like say I get tree wey dey grow money for my room, even girls wey no even send me Don dey give me green light but them no sabi say I get eye problem. 24/7 I dey repeat that place wey say 30billion for the account o for Davido song.

Anoda one Na for paddy (friends). I don get plenty friends since when I joined Steemit. I don meet people like @gbenga @ejemai @samstickkz wey I no ever think say I go meet. I don get another paddy wey dey show me how to take run Cryptocurrency.

The last one Na say, I don get improvement for my creativity and human value. I fit even write one full note about you @ogoowinner even though I never meet you but I go like meet you.

Abeg help me greet these whales @ehiboss @ned @ewuoso @gbenga @eurogee @ejemai @onequality @destinysaid @sussan @nairadaddy @samstickkz because Na dem dey always come around for our posts to come upvote them. Na dem dey always say "Carry Go" with their upvotes.

Abeg make Una no forget go church go pray for our country tomorrow make things begin go well for this country.

the thing no be small

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.14
JST 0.030
BTC 68523.63
ETH 3260.51
USDT 1.00
SBD 2.66