HiWhy I Take Like Steemit....Contest By Aunty @ogoowinner

in #npc8 years ago (edited)

FB_IMG_1516290603305.jpg
My better people, I dey hail ooo. Na Waka I dey Waka wey I see this ogbonge yarn. @ogoowinner, auntie I hail ooo, abeg no vex say na later comer I be but I no wan carry last. Auntie talk say make I yarn una the reason why me take like steemit.

Steemit na baba, no be joke ooo, no be small thing. Dis babe don suffer, I broke so tey beggars dey dash me money. Paale and miile don kick Jerry can since, I broke say na run I dey run from people as a God fearing babe, I no fit do olosho or akuna. Na one of my Bros @rufans wey he tell me about Steemit. After I jam Steemit and him Steemit kan dey chop all my gbese like fufu and vegetables soup.

Another tory na I dey write wella, poem ooo, story ooo pelu motivational thing. Ni gba mi mo ma ya photo gidi gan, no vex say I carry una enter my language na yoruba girl I be and I gas represent. As I dey read other people own I dey improve, dey learn how e dey go.

Steemit again dey help chop better, as a Yoruba girl Amala na first choice then nak am with ewedu and gbegiri with plenty meat. For here I dey see better food we go give me better body and make I strong kakaraka like bagco super sack. No be small thing ooo

Before if you mention coins na Kobo dey enter my head no laugh me ooo. Steemit don teach me say something wey be cryptocurrency dey and na coin Dem be. Market dey shake now but we no fear, e go so rise up again.

Why I kan take like am again be say competition dey boku. If you think say na u better come here, you go know say you dey learn. Competition plenty, you go write your own and you go see say another person own gara pass your own. Steemit na bae na even boo sef. If Steemit na man I go marry am.

Na my own be that ooo, y Steemit dey sweet me for body.
I go like throway salute to @ogoowinner, friends, followers and following and also upvoters wey I don make on steemit, Oluwa bless you
For our Auntie wey do this correct contest, Auntie you to much. Anybody wey say your water no go boil e kettle no go hot.

Una bye bye

Sort:  

heheheheheheh 😁 😁

😀😀😀

Coin Marketplace

STEEM 0.08
TRX 0.30
JST 0.035
BTC 109888.74
ETH 3888.06
USDT 1.00
SBD 0.52