Making the Steem social network better by @ogoowinner, NPC
Auntie @ogoowinner don come back with another ogbonge one. She yarn say make we talk wetin we want make Dem add for Steemit.
I go start with the delete matter. Sometimes when I go just yarn something and later when my head correct I go wan remove am I no fit. E go pain me die, make delete dey. E necessary
Another thing wey I want make Dem add na private chat. Like me nau, dey get somethings wey I wan yarn auntie @ogoowinner and I no fit yarn am because no private chat. I no fit dey ask our Auntie her number for her post.
Another thing wey I go like make them add na notifications, wetin I dey try yarn be say when person tag you for e post you go no. Because when I dey thank people ontop Steemit Dem no dey know because nothing dey tell Dem say this fine girl dey hail Dem.
Auntie @ogoowinner if dem fit do this one for me I go blow Dem kiss wey big pass Nigeria.
The picture I used is an igbo music icon Chief Stephen Osita Osadebe