THE CREED OF LIFE: NPC EPISODE 3

in #npc6 years ago

I stand gidigba say people like "notice me" and make them they show them love

I stand gidigba say people na equal

I stand gidigba say this world large enough to put everyone for one crib

I stand gidigba say everybody know book anyhow anyhow

I stand gidigba say people sabi things differently

I stand gidigba say everybody get witch and good but me promise say i go try dey cage my witch and dey allow my good fly like bird.

The truth be say na attempt to build shoulder of who big pass and who fit control people pass na make race, religion and and social palaver enter matter. Anyway i personnaly choose to be human before any other palaver

I go treat my fellow brother like myself

I no go dey behave anyhow as to how the person do but as to how i want the person to be

I no go enter "mago mago" business wey go do person bad

I no go judge person instead i go try understand them

My mind go pure. No wayo, no envy

I go do one better thing before i leave the place

I go try make i no shake whan yawa gas and bad news come

I no go allow fear shake me

Me i know say person thought strong o. So i no go allow bad thought enter my blood as i go sharperly replace am with better thinking

I no go be another person. I go be myself. I go owe my side well.

I stand gidigba say i fit make a difference if i put my best for the matter.

I stand gidigba say this life na "waka" no be bustop or competition so i no dey run with anybody but myself.

I stand for no gbege side (peace)
I stand for love lane
I sta251.jpgnd for forgiveness parol

I must do the right thing wether he easy or hard
For this life i go "live am well" no b just to "dey"
My life go set as example for people.

Sort:  

Upvote my post and follow my channel so I can do same

https://steemit.com/@rafalklimsiak

If you want me to upvote your post make sure to add hashtag

#upvoteforupvote

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.12
JST 0.027
BTC 64664.97
ETH 3401.05
USDT 1.00
SBD 2.31