MY NPC ENTRY FOR TODAY:WETIN FRIENDLY ENEMY DON DO ME.

in #npc7 years ago (edited)

IMG_20180121_065127_962.JPGSource

Me i don land again for this ogbenge pidgin challenge,this one na my entry.Make i first greet my madam at the top @ogoowinner wey upvote me for the last challenge wey i enter upon say i enter late,and madam @ogoowinner don bring another challenge come again today.

The tory wey i go tell unah now na about my sister,and her friend wey her náme na Ada.

Na so she and the Ada dey do friend sote em reach time make them enter university them talk say na the same university wey them wan read,or say them no go gree go school again.My papa talk okay make em go meet Ada papa,them two go register them for the same school.Time reach them enter school,tory come dey reach from school to house say them two dey bath together,this kind friendship i never see oo.
IMG_20180121_065232_750.JPGSource

Na em reach one day wey me,papa and mama dey for house my sister carry man come back house talk say the man wan come talk about marriage say em come see papa and mama make them talk date wey em go carry em people come house come pay my sister bride price.Papa talk okay carry date give am,the man go.IMG_20180121_072713_250.JPGSource

Oyah the day wey the man suppose come with em people pay pride price we wait for the man we no see am,my sister call am sote she tire carry phone give me make i try,me i try em still node pick call.My sister dress go the man house,we wait for my sister we no see am.Na so we dey wait for my sister momsy phone ring she pick am em come be my sister she dey cry say she dey hospital.We rush go hospital my sister dey for hospital bed em dey like person wey big motto jam two times,we ask am wetin happen em talk say na the man wey beat am,me na area scatter na i rush go the man house me no dey like tory were my sister dey make i go scatter something.
IMG_20180121_074418_287.JPGSource

As i dey reach the man house na em i see Ada my sister friend on top bed,haba wetin i see shock me,so me i no doll i still rush the man give am one slap,na em come dey explain give me say my sister carry Hiv say na so she dey follow men about say her friend(Ada) come one day carry phone give am,em and one doctor wey run test on my sister talk finish say my sister carry Hiv and say the doctor even talk say em don sleep with my sister too.The man come ask me were my sister dey make all of us go hospital make em show me say wetin em dey talk na truth,Ada still dey bed dey shout say na true.All of us reach hospital we come run test sharp sharp result comot,na negative me i no come get energy do anything again,na em the man come dey beg say no be em fault say na Ada wey do am.Papa tell am say nothing go do make em marry my sister again,the man plead papa no gree em comot,from that day we no ever see Ada with eye again she no even go back school again self.

Na here me dey end my tory,people wey dey read i hope say i try,friend enemy dey real oo.Thank you madam @ogoowinner for the ogbenge challenge wey you carry come again,God go bless you.
IMG_20180120_085421_966.JPGSource

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.13
JST 0.027
BTC 58445.95
ETH 2616.08
USDT 1.00
SBD 2.41