FRIENDLY ENEMIES

in #npc7 years ago

Hello Fellow Steemians..

Since I don join steemit, I fit say nah steemit sweet pass for all social platform.
Now make I sharpaly enter for the challenge self. Nah this naija pidgin challenge by sister @ogoowinner, nah enh I wan write about.
Make I no forget say nah my first ever contest for steemit be this.


E get this friend wey I get, her name be TOSIN, we gather grow together for same street , nah everyday we dey meet , dey follow talk everything. Wen we con grow up small, I be 19years that time and I don dey get toaster well well. E con get one guy like this wey we both like , we go dey talk this guy matter any evening wey dis guy pass us by. Naso young ladies for our area dey do one kind wink eyes for this guy because enh yellow and enh tall, make I no lie, this guy handsome nah Dolapo be enh name.

CDS8lYAWIAA9Voh.jpg
credit

One day like that, naso Dolapo come stop me for road dey toast me say make we dey gather roll, I con dey laf am inside say at last I don get this guy, but I no fit show am say I dey happy like that, I con pretend tell am say make we talk later , that make enh give me time to think am well.
As I con see Tosin my friend, I con tell her my good news , how Dolapo come meet me and how I pretend tell am make enh give me time to think am. Nah so my friend con dey feel somehow, and me I no know wetin do am before, I con dey ask am say wetin do her, say e be like say her mood no dey ok, but she no talk.

Wetin con pain me pass be say, Tosin con later go behind go spoil me for Dolapo friends say I be dog, I dey carry different guys waka, say I useless, she add put say she just dey manage follow me talk. She think say if this our guy don hate me, that she fit get chance for Dolapo heart.
I con later see this Handsome Dolapo, I con gree for am, when we con dey roll, nah him com tell me how Tosin don kill me and buried me for back, I con go confirm am……… nah like that trailer pass between me and Tosin oo…


Nah one of my bad experience about friendly enemies be dat oo.. make Baba GOD dey save person, we no kuku know who we wan trust again.

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 62755.94
ETH 2446.28
USDT 1.00
SBD 2.66