Creed #as I take see life#

in #npc6 years ago

Creed: creed na wetin person belief or wetin person stand for.
As I dey like this, I belief sey anything wey person wan do make Im think am wella first. As life dey, if person wan climb mountain, he gas look am, access am well well . if person no do like that he go just fall yakata for ground. All the things wey dey this life na vanity upon vanity i tell you but as Una dey see me like this I belief say if I no enjoy life, life sef go vex for me .I don tire to dey see person wey get wey no fit use am. If person no use wetin im get ,the thing go just spoil
E be like say make person get planty yam for house, make I'm no chop am because Im struggle plant am, the way the thing go spoil, everything go just waste .
Life dey easy for only people wey sabi live am, like play like play, every body go still die weather for morning or for night. Make everybody live life like say na the last day.
As e dey be, na everybody get wetin Im suppose do for this life . if Im like make e no do am well, e go just be like say Im no do am at all. Oyinbo dey always talk something " whatever is worth doing well" wetin dem dey talk na say if anybody wan do anything, small or big, if Im wan do am ,make Im do am wella. image

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.13
JST 0.029
BTC 65885.06
ETH 3440.60
USDT 1.00
SBD 2.65