MAKING STEEMIT A BETTER PLACE FOR ALL.

in #npc7 years ago

My kontri pipu, I greet una welli don, I wn put mouth for the matter wey my big sister @ogoowinner carry put for ground. The matter be say make pipu wey de low reputation get better advantage like pipu wey get high reputation.

image

Make steemit fit better for everybody, as for me I never to sabi plenty things for this steemit but wetin I know be say no be everybody de see wetin I de post, even pipu wey I de folo no de see my work na that one de pain me pass, I wish say them fit just make am very possible make everybody de see wetin I de post.

The oyibo pipu wey build this better platform build am say make we de use am help ourself but e be say some pipu de take am personal dem go just read your story and go comment dem no de help encourage person at all at least make dem de upvote person woke.

I observe say person wey de high reputation na dem de get beta upvote, we wey them introduce enter am no de get better up vote at all, I wish say this adjustment fit de, mk dem de help people wey still de low reputation make dem sef de get everything as the ones wey de high reputation.

I thank una say you help me read am

Sort:  

Nice...
Na true talk my sister.. People with big big rep dy use chance we with small rep.. But wetin we go do than to also struggle and reach big rep for us too dy jolly the honey wey they there..

@gprince ✍️

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 58391.36
ETH 2348.06
USDT 1.00
SBD 2.36