Life creed: Na my obonge entry be this

in #npc6 years ago

I believe sey everybody has the right for em to be seen, heard and loved.

I believe all of us de equal

I belief say this world wey we dey so get enough space wey we fit stay.

I belief say na everybody Baba God carry talent give

Me i believe say everybody no be the same o

I sabi say no be only winch and craze dey people head, person still get correct side so na to panya the winch make the correct side dey show well

I believe say this see every person as human being first. So mk we take life je je

believe say everybody nah oga for were dem sabi there own thing that nah why we get footballer, musician and tailor.

I believe say the way make we for treat people nah so dem go treat me so i dey treat dem wella.

I believe say dis life na jeje so I go just take am simple

•I dey always put for mind say nothing for this earth dey impossible.

•I believe say no body too small so I dey make sure say I treat everybody well

•I believe say if you dey use anoda person clock for yourself, you fit just crash land for road.

I believe say to show love make sense

I believe say peace na better ting

I go de give well well

I go de forgive people too, i no go de carry things for mind

This one na my pledge and i senora go do this things wer i yarn image

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.12
JST 0.031
BTC 57455.91
ETH 2919.98
USDT 1.00
SBD 3.58