My people make una help me thank God, steemit don do am

in #npc7 years ago (edited)

wetin steemit don do for me, na for pidgin e dey always sweet me to write am pass o and i been dey think say na for only @surpassinggoogle #untalented contest i fit write am, but @ogoowinner don give me opportunity to, enjoy my self aunty ogoo you do well o, abeg no be everytime person go dey yarn big big grammer, abegie even oyibo sef no fit speak our own, I know say If them dey read this my post e go be like chineese for thier face, naso e suppose be we use this one pass them.
PicsArt_01-17-10.59.20.jpg

Make we enta the tori for today as my write for my topic say make una help me thank God steemit don do am.

wetin steemit do

  • He collect me for faucet hand
  • He collect me for Facebook hand
  • He collect He collect my selfie and slay queen talent for my hand.

Before before na so so faucet I go dey enter they find site wey I fit claim free cryptocurrency but since wey I join steemit I don learn plenty things for this cryto matter for #genesisproject and for ogoowinners forum wey @ogoowinner open to discuss crypto matter for cryto noobs like me to fit learn.

to cut the long tori short steemit don help me dey get value for all my time wey I don waste online and for social media, steemit help me shut those people wey be say every time dem go dey tell me say, Funke you too press phone Funke you too snap picture some go even tell me say The day wey this your phone go spoil you go sick o

all this talk no be lie o na true talk, them talk, even though all this talk never change but now, when them dey talk I fit proudly shut them up when I show them all the better better things wey I dey do on top steemit and all the things I don achieve for steemit .

even my elder brother, naso him go dey talk, when I complain to am say my data dey finish quick, that time wey I just enter steemit make e subscribe for me e nor go gree e go tell me say I nor get better thing to take am do say na mmm ponzi me I dey do online say him no wan hear say them carry my money go o, but me I get luck for that side sha any ponzi wey I wan join they day wey I wan register na that day e dey crash, una wey ultimate cycler and mmm agents chop their money make una nor vex, God don send steemit to come to restore all una loss. back to my brother matter since the day wey him join steemit e nor look back again o him na one of the ogbonge game reviewers for steemit now na @juliusfatai be him name.

For steemit I don get friends, I don get mentors, chai

make I end my tori for here cus if I begin open book we nor go comot for here today. I thank una.

Sort:  

Lol!, funke this really funny. I just keep laughing while reading all through the content. Is not only you that dey do tell about pressing phone. My is worst, my mum, sis and even place of work wen am less busy and pressing my phone they still complain, Na so life be.
But when I told dem what I have earn so far on steemit, dey where just like encouraging me to press more even asking me to teach them, now am the boss at home and place of work.........😂

Wow... All I wan yan now be say make baba God favors dey fall on u... And make upvote fall on you... Lastly make Range Rover sport with blessings fall on u.... Infant make God blessings bend your life.... Can I hear u yan Amen

Lol If range rover fall on me how i wan take survive kan enjoy the other blessings

I hear all the plenty, plenty talk wey you talk and I agree, but that one wey you say you don get friends na lie. Which kind friends wey you get and I know dey among them? No lie for anybody for this place joor.
But pidgin dey sweet o. See as I come free.

I swear you need to see the smile for my face as i dey read am.

@rabamaker e be like na you nor wan be my friend o cus i gather friends for this platform no be small.

Congrat girl, i da join yhu happy. What??? So na yhu b d girl wen i da hear about??? Maxwell friend sister???? Am happy for yhu.

Oh....I nor know you o buh e be like say you know me finish

Azin eh my Sis i dey feel ur write up gan.. Great piece there, i feel the inspiration and content. You will make a prolific writer oh

Na so my mi le talk am oo say i tu dey press phone say she no no watin i dey press

Congratulations! This post has been upvoted from the communal account, @minnowsupport, by phunke from the Minnow Support Project. It's a witness project run by aggroed, ausbitbank, teamsteem, theprophet0, someguy123, neoxian, followbtcnews, and netuoso. The goal is to help Steemit grow by supporting Minnows. Please find us at the Peace, Abundance, and Liberty Network (PALnet) Discord Channel. It's a completely public and open space to all members of the Steemit community who voluntarily choose to be there.

If you would like to delegate to the Minnow Support Project you can do so by clicking on the following links: 50SP, 100SP, 250SP, 500SP, 1000SP, 5000SP.
Be sure to leave at least 50SP undelegated on your account.

you talk well my sister.

me wey just dey start dey look to you as a mentor

Baba God go dey bless u dey go

wehdon ma'am

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.13
JST 0.028
BTC 59508.12
ETH 2603.38
USDT 1.00
SBD 2.39