If you ask me na who me go ask?? pidgin challenge/contest by @ogoowinners

in #npc7 years ago

na Aso Rock for Abuja be dis
aso rock.jpg
image source

I grow up for las vegas USA, a beg mak una forgive my pidgin if e no be like d typical naija own, but i go try my best yan am well. lol. wetin steemit don do for me na somtim wey be say e shock me till today.

e get one of my friend @imohdave wey tell me for facebook sey mak i try seesteemit sey d stuff cool wela. hhhmmm, mak i no lie for u, d tin taya me cos all this site thing dey be me like scam. so, one day, i just try visit the site , register too, come start to dey use am. thou d thing been hard at first, but with time i come adapt com even dey like steemit pass my friend wey even show me way, lol.

my brodas and sistas i don promote steemit for my work place sote almost all our staffs dem get account with steemit, my boss selve com buy, as in, invest for steem sote the man now won take steemit as him permanent job. who go see beta wey no go rush am.

steemit self don help me meet plenty pipo wey get head ehn, wey be sey them too know something. the fest peson wey me meet na @futurethinker @reko @ejemai @surpassinggoogle omo dem yapa. how i for take meet dis people if no be steemit.

as e be so now steemit go soon be my fulltime work because the future for steemit strong wela. Apart from the money wey i dey raise here, i dey also sell my brand for dis platform. mak i com use dis time trowey my salute for our sis @ogoowinners. sis i hail you oo, becos after you na still you.

una thank you as una get time to read dis thing and i hope sey my pidgin no too wowo like tha, lmao.

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 58560.83
ETH 2491.85
USDT 1.00
SBD 2.40