THE CREED OF LIFE: MY PIDGIN TRANSLATION FOR AUNTY@ogoowinner

in #npc6 years ago

My one and only @ogoowinner you dey really inspire me with this better things wey you dey talk about for all your contest. This na my pidgin translation for the creed of life.

Naija Pidgin Challenge
[image source]

This na our own Richard Mofe Damijo the man wey no gree old ever young.

I no for my mind say all of us get right make people see, hear and love us wella.
I no for my mind say all of us dey equal even for baba God eye na so we dey.
I no for my mind say as this life big so, e fit contain all of us.
I no for my mind say all of us sabi one thing wella for the plenty things wey dey this life.
I no for my mind say all of us get one yori yori thing wey make people like us wella.
I no for my mind say all of us get craze and better side for inside us but we dey try keep the craze side dey show the better side because na only that one dey bring peace o.
I no for sure say our religion and popular level no be anything for this life, I prefer to be human first before all this things wey dey this world .
I go treat my neighbor as I want make dem treat me too.
I no go show more respect to people because of the money wey dey get but the better thing wey dem go do for this life.
I go comot my hand fit anything wey go affect or even kill my fellow human.
I go try wella sabi as people dey think instead make I dey judge them.
I no go allow jealousy and big eye control things wey I suppose do.
I go do one ogbonge better thing wey people go see wella before I commot this world
I go try no allow the bad bad things for this life affect my shine
I no go allow fear fear catch me wen I wan do better thing
I no go dey think evil instead I go replace am with good and peaceful thinking.
Because eh!
the things wey we dey think dey very powerful
I go always dey real, I no go dey copy people up and down
I no for my mind say I fit touch lives if I put my heart for the thing wella
I no for my mind say this life wey we dey so na je je ooo no hurry hurry, so I no go drag with anybody oo

I dey gallant with peace
I dey gallant with charity
I dey gallant with mercy
I no for my mind say justice na for everybody pata pata.
I dey gallant with human race too
I make my own decision to “live” and not to just “exist”
I @oyinoza will abide with this creed of life till the last time

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.12
JST 0.027
BTC 64593.80
ETH 3405.02
USDT 1.00
SBD 2.32