Chai! See As Steemit Don Change My Tori (@ogoowinner Nigeria Pidgin Contest Entry)

in #npc7 years ago (edited)

logo.text-big.gifimages.jpg
source

Hmm....... my country pipu wey dey naija, africa and all over obodo oyinbo I greet una o. Dis one wey I dey do now na him den dey call " UNA GO HEAR WEN (meaning una go hear tori wey no get any mixture).

But before I begin dey yarn una how STEEMIT don change my life, I go wan throw wey salute first to the pesin wey make all of us dey speak pidgin for dis platform. The pesin na my friend, the ogbonge fine baby wey all of us dey call @ogoowinner. I hail you o for dis thing wey you bring con dis platform. The tin make too much sense.

I don talk say if i get chance to become the presido of dis our naija, part of the thin wey I go do na to change our lingua franca to PIDGIN because ne everybody sabi speak am. I no say una go agree with me for dis one?. Hmmm.

Dis tori wey @ogoowinner say make we write go plenti but I go try make short.

MY OWN STEEMIT TORI


IMG_20170917_082014[1].jpg
The time wey I join steemit na the time wey MMM (ponzi scheme) slap my face wey be say I no dey see again. Dat time he con be like say yawa don gas and dis life go end. The tin hit me so tey I no dey feel my leg again. Na as dis tin dey happen na him God con send dis man to me wey con yarn to me about steemit. The name of the man na @tojukaka. Make I no lie for una, the day wey he dey talk am I no one belif am. I think say na anoda ponzi scheme. But in talk say make I no wori say in go make I just try am.

May pipu na so my steemit tori start o. Make I no lie for una the time wey I con na moni I just won make for here, but as i con land gidigba for here na him I con see say e get sumtins wey me sef fit do wey I no no say I get the talent o. Na one of the beta tins wey dis platform don do for me be that.

Den I con meet orisirisi persin dem here wey be say if for no be steemit I no fit meet them at all. All of dem na beta pipu wey sabi love, sabi give and sabi encourage sef. Two hands up for una.
IMG-20150107-WA008[1].jpg
Na mi be dat o

I like make I dey sing and I no say one day I go do one song like dat for steemit wey be say everybody wey hear am go like am. Na steemit dey make me dey think like dat o. Na anoda tin wey i learn for this platform be dat o. Steemit don make the dream wey I dey dream before con become real and I neva tire o becos I go still do more. The tin wey I just need to do now na to just think am. You no say anytin wey pesin fit conceive ego fit achieve . Steemit don make dat one sef happen for me.

Dis one wey I wan mention now na the one wey I like pass for dis platform and na him be say THE KIND TIN WEY ALL THE PIPU FOR DIS PLATFORM DEY WRITE FOR HERE TOO DEY MAKE SENSE. If I say make I dey call the name of pipu wey don helep me well well for here wit wetin den dey write, I no go leave here today o.But I go try mention small sha;
@surpassinggoogle, wey dey always talk say everyone get talent and na true. Boy Terry I hail o.
@michelle.gent, wey dey write tori about vampire, family and dog. I like am no be small.
@tojukaka, (aka. k-money) wey dey always teach how we go do tins for dis platform.
@ejemai, the correct oga wey dey make the @stach work dey spread steemit for naija and africa. I greet o.
@stellabelle wey dey give us all dis gif for steemit. Madam I greet o.
I go just mention the name wey remain. Correct pipu like @ewuoso, @gbenga, @sussan, @samstickzz, @curie, @onequality, @honourmaus, @amec, @immoraja, @ehiboss, @gloglo, @ @oluwoleolaide and many other pipu dem wey I no mention dia name. For all of una I say TWALE.

IMG_20161010_154832[1].jpg

Make I say the truth o DIS STEEMIT DON BETA MY LIFE WELL WELL. See as I dey write tins wey be say pipu all over the world con dey read am. Chai! se na me be dis? Me sef go make sure say I helep tell every pesin wey I see, con tell dem say STEEMIT NA THE BABA.

@ogoowinner

I thank you for dis chance wey you give all of us to talk our mind for pidgin. Thank you my beautiful babe wey get swag..
Make una no forget the thin wey I talk before say

IF ALL OF UNA VOTE FOR ME AS UNA PRESIDO FOR 2019, I GO MAKE THIS OUR CORRECT PIDGIN LANGUAGE(BROKEN) TO BE OUR LINGUA FRANCA (lol).

All of una wey come for my blog, I dey thank una o.

Whats_App_Image_2017-09-30_at_5.48.28_PM.jpg

@optimistdehinde love all of una.

Sort:  

Lol. This your pidgin make sense oh. You don really do well for yourself. I hail oh.

Na so we see am o. Na @ogoowinner cause am o. Lol. Tank you o

Did pigin tin go make people comot their teeth. Yu do well my oga

Na serious teeth cutter o. But na wetin man go do. Steemit dey do am o

Tank you o my sister wey get swag. Lol.

Bruv!!!I hail ooo...see koret yan mak sense die mai i no lie u try ova try sef con dey wori u join..smile@optimistdehinde

Na try i dey try o. Make God helep us o for dis steemit parole o

Smile, abeg make d paroole sure ooo.
Kindly visit my blog @optimistkehinde thanks.

Wow! Oladehinde dropped it like it's hawt! Fantastic write up

My padi,u yarn well no be small. U make brain die

LoOOooL this was a funny read, thank you for sharing your thoughts in pidgin!

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.17
JST 0.033
BTC 64258.81
ETH 2772.25
USDT 1.00
SBD 2.65