THE CREED OF LIFE - Naija Pidgin Challenge #3

in #npc6 years ago

365.jpg
Image is Mr Ibu

I believe sey everybody don reach to hear, like and love themselves

I believe say every one dey equal, nobody better pass another person

I believe sey this world big reach to contain everybody

I believe sey everyone na king for him own lane

I believe sey everybody dey special and u no fit find that kind person for another place

I believe sey everybody get him black and white side inside body. My own na to make sure sey the good part surface and the bad part no comot surface

I believe say where person come from, where him de worship and him position for society, dem just carry am for front to carry repress for society. As i de so, i go be human being first and i no go allow, tribe, religion or class determine how i go treat people

I go treat people the way i want make people treat me

I no go carry people based on who them be now, but wetin and where dem go reach tomorrow

I no go put hand for business or anything wey go spoil person face

I go make sure sey i understand other people

I no go allow bad belle control me at all at all

Before i leave this world, i go do better ogbonke thing keep for ground

I no go allow catata weak me

I no go allow fear catch

Me no go allow bad things flow for inside my mind, but i go make sure say better things go de am so as to push my mind go where e suppose be

I go make sure sey i no live fake life

I no sey if i put my mind do something, better go

I no go allow person carry me run anyhow race, i no get that time, i go do my things slow and steadily make i for see results

I believe sey we suppose live peaceful life

I believe say, if we get pass another person, we for de give

I no believe sey we suppose to the carry other people for mind mek our chest come de big like sey we de gym

I believe sey we suppose love one another like ourselves

I believe sey we suppose mercy for others

I believe sey person no suppose do another person bad waka without appropraite reward

I believe as we de live so for this world

I don gree for myself sey i go enjoy this life wey i de live so, no be to come waka pass like tree

I Nduyeobong Friday Aniekan don gree to follow this creed until when my time reach to leave this world

Coin Marketplace

STEEM 0.29
TRX 0.12
JST 0.032
BTC 59120.07
ETH 2921.92
USDT 1.00
SBD 3.79