NIGERIA PIDGIN CHALLENGE EPISODE 3: THE CREED OF LIFE

in #npc6 years ago (edited)

My people i hail ooo, nah still your boy Bestman wey tanda for ground here oo. Abeg nah wia i been dey wey this kind better contest for steemit reach episode 3 and i just dey participate now.e be lyk say i don dey sleep untop bicycle Any way thank you @ogoowinner for this your contest,no doubt say e dey sweet me for belle well well. This picture una dey see nah baba and buhari just some days ago, so no doubt baba letter nor spoil anything between this two men.

My people this nah my own interpretation of aunty @ogoowinner creed

Me i belive say every human being get the right for people to see dem, hear wetin dem dey yarn and to recive love from another person.

I dey sure say everybody dey equal

I belive say this world dey big enough to allow everybody live inside as one without scatter scatter.

Nah true fact say atleast e get one area of life wey person dey very good at. E nor possible say person go be overall mumu.

I belive say as our faces dey different nah so we dey special and unique.

No doubt say everybody get devil and angel wey dey live inside our mind. Now e don become our own responsibility to kill the devil, so that the angel inside our mind for fit breath.

My people things like religion, and social status nah things wey some bad people create so as to make people dey under their control so that them go fit feel say them dey better pass the next person. So before me i go join  any religion or any class, i go first be human being.

I go treat people exactly the same way wey i go like them to treat me . 

I nor go look face when i they relate with people.

Me i nor go invole myself with any thing wey go cause pain to the next person.just because me i wan jellof.

I go try to understand people and as bible warn i nor go judge.

Things like greed, jealousy and envy nah im dey cause scatter scatter for this world. Me i nor go allow am enter my mind at all

Me i don decide say before i go meet God i  go do one better thing wey every body go take remember say  i been dey here.

I go try to dey strong wey bad things happen to me.

I nor go allow fear worry me.

I go make sure say my mind go only  be a place for good and better things, i nor go allow any bad thing come enter my mind because me i know say wetin person think dey very powerful.

I go always try to be who i be, i nor go dey go about they copy another person

I know say anything wey me i put my mind to do, i go make better impact.

I belive say life nah per head, so i nor go dey compete with another person.

I tander for peace.

I tander for charity.

I tander for forgivness.

I tander for love.

I tander for mercy.

I tander for justice for all.

I tander for the human race.

I don sit down decide say me i go live and enjoy life i nor go just  show face for this life.

I Bestman don conclude matters say i go live and abide by this creed as long as i dey alive.

My people thank you. Hope una enjoy this post. Once again @ogoowinner i pull cap for you.


Coin Marketplace

STEEM 0.29
TRX 0.12
JST 0.032
BTC 63867.81
ETH 3135.89
USDT 1.00
SBD 3.84