My creed of life: Niaja pidgin challenge organise by our good ladyv@ ogoowinner

in #npc6 years ago

Na better yarn say everybody get right make people notice them and make them yarn make people listen

Na better yarn say na from woman all of us comot so we be the same all these long leg thing no suppose dey come up

I sure say the world dey big enough take carry all of us wet dey earth

I sure say everyone na correct person for hin own lane

I believe where u from, where u dey worship and social status no matter, na just things way some kind men them create so that them go fit control other people, cause strife and put inside people that supremacy mentality. So I don choose to be "human being first" before I be any race, religion or class.

I no go react to people based on
who them be, but who I want make them be.

I confirm say the issue of "my brother" na mumu thing and I pledge say I go be my brothers keeper

I go treat people like I want them to treat me

I no go respond to pesin base on him who be but based on how I want make him dey

believe say dz my small brain fit do anything great

I believe say for life everybody get him own lane and me i no go leave my own enter another person own

I believe say peace nah d koko

I geh d believe say to dey helep other nah d way

I believe say to dey forgive nah way of life

I believe say love dey

I believe in justice for everybody.

I get believe in human race.

I @ Godsfield will abide by this creed all the days

image

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.12
JST 0.028
BTC 65439.84
ETH 3570.73
USDT 1.00
SBD 2.47